
17/05/2025
Make I tell una the truth.
Wetin Chelsea and Man United play for first half funny me ehh, dem just dey play like Amateur players.
To control ball self dey hard them, to complete passes na case, to create or open to space na problem, infact the both clubs no deserve to collect salary this week forget say Chelsea win.
• Shebi una know say if to say games remain like 7 Man United for enter relegation.
• Shebi una know say if to say Liverpool and Man United need those points Chelsea for no win two of them.
Wetin come dey funny me pass for where Chelsea and Man United dey be say, di both clubs know where their problem dey come from but if transfer window open dem go begin sign wonderkids from Brazil.😄