
09/06/2025
🎤 *CoreNews Pidgin Bulletin –9th June 2025 Edition*
🏘️ Gist Wey Drop From Jirapa:
1. *Still No Show for Jirapa Durbar Ground* 😴🎺
We still dey look the place like cinema without film. Abi durbar get stage fright?😔😔
2. *Taxi Fare Don Fall Like Bread Price After Famine* 🚖⬇️
Fare don drop reach GHC43. Even the drivers dey shock pass passengers!😊😊
3. *Wa–Jirapa Road Now Be Obstacle Course* 🕳️🚗
Every day, new pothole dey open like betting shop. Na legs we dey use pass now.😉😉
4. *BECE Dey Start Wednesday – St. Anthony’s Dey Boast* 📚🔥
Dem say this year be their own. “We go top!” Fingers dey cross, heads dey cram😄😄
5. *Mary Don Carry Belle – notice to those who chop dema Eid meat alone* 🤰
If you choped your Eid meat alone aaaah don't worry Mary Don Carry Belle. We go meet in December.🤪🤪
6. *New JMYA Executives Go Greet MCE – We Dey Wait Plans*🤝⏳
Dem go shake hand finish, but when dem go show work? House dey wait👌🏿👌🏿
7. *Barbers Rush Go Buy Sterilizers After CoreNews Exposé* ✂️🔍
Some barbers fear expose, rush buy sterilizer—but e dey work or e just dey shine?🤪🤪
8. *Last-Minute BECE Donations Don Dey Drop Like Rain* 📦🍚⏳
Maths sets, rice, and "God go help you" everywhere. Whether e help or not, we move!😄😄
9. *Rain Don Land – Jirapa Roads Don Drown* 🌧️🛶🕳️
Moto dey swim, people dey paddle. Some junctions fit start fish farming soon😄😄
10. *No Greening Ghana This Year – But Where The Old Trees*? 🌳📸👀
If you fit see any tree wey survive last year planting, raise your hand. E rare pass honest politician😄😄
🌍 *Gist Wey Fly From Outside Jirapa:*
1. *Trump and Elon Musk Dey Do Billionaire Wrestlemania 🤼💸*
Na tech vs talk. Elon dey build rockets, Trump dey drop bomb tweets!
2. *Wontumi Don Finally Bounce From NIB Cells* 🚪🕺
He come out limping. Case still dey hang like Wi-Fi wey no dey connect🤪🤪
3. *OSP Declare Ken Ofori-Atta Wanted – Interpol Red List Dey Call Am* 📜🚨
If you see am, no shout. Just whisper “you be global now"😛😛
4. *CR7 No Dey Hear ‘Retire’ – Portugal Win Euro 2025* ⚽👑
Ronaldo na living cheat code. Man still dey win like say e dey 25💪🏾
5. *Bibiani Gold Stars Shock Nation – Win GPL Title* 🌟🥇
Nobody see am coming. Dem lift the cup like dem born with am👏👏.
6. *School Feeding Matter Turn Wrestling Match* 🍚🤼♂️
MPs and chairmen dey drag food like jollof for funeral. Meanwhile, pikin bellies dey sing chorus😎😎
7. *24hr Economy Don Start, But Boys Still Dey Idle*🕰️🪑
Dem no get skills, or dem no get godfather? Abi the 24hrs na for Accra alone?😁😁
8. *Dollar Sellers Dey Panic – JM Press Am Down Like Remote* 📉💵
Everybody dey rush sell before e become coins. Forex guys dey sweat pass boiled yam😄😄
9. *GHC1 Levy Debate Dey Hot Like Waakye Firewood*🤷♂️💰
Abi hidden tax or just harmless charge? Ghana turn panel discussion overnight.
*Copyright , 2025*