02/06/2025
Mama Pay Area Boys beat Vice Principal For Ondo Because e Stop WAEC Student To Dey Cheat
One student mama for Complete Child Development College for Aule, Akure (Ondo State) don hire touts come beat Vice Principal of di school. Why? Because di VP stop di woman pikin to dey cheat for West Africa Examination Council (WAEC) exam.
Di Vice Principal, Mr Rotifa, catch di student dey use phone cheat for exam hall. E collect di boy Android phone.
Di student mama vex well-well because di VP no gree make di boy cheat for dis WASC exam. She even threaten teachers and di school say: "If una stop my pikin to use phone for maths exam wey dey come, una go see shege!"
But di Vice Principal no fear! E talk say "I go repeat am o! If any student bring phone enter hall, I go still collect am. Nobody go cheat for here!"
As dem no gree settle, area boys enta di school area. Di worst part? Police don even show up, but di touts still drag Rotifa comot from police van, beat am till e turn "blue-black"