28/04/2026
For people wey dey wonder why Man United dey always play games on Monday, Oya carry chair come make I explain for you.
• Most times, no be Premier League dey move di matches go on Monday people wey dey push di games na Skysports and TNT wey be EPL broadcasters.
• Incase you no know, Skysports and TNT dey pay Premier League better m0ney wey give dem right to select games wey dem go show specially.
• Skysports and TNT dey pay Premier League more than $8b!llion (over 10 trill!on naira) for di 4 years package and for dem to recover di money dem gats pick one big game wey dem go show specially after showing weekend games.
• No be every time dem dey show am, any match wey dem see say go generate dem m0ney dem go select am .
• All of us know say Man United no dey play any European competition or any other competition so Skysports and TNT go just select Man United match go Monday so that plenty people go watch am make dem fit generate money.
All of us know how big Man United fan base be and how rival fans go dey rush to watch Man United games.
So Man United playing on monday no be w!ckedness na business cause am.
Amen ?