20/08/2026
Baleba Too Expensive? Carragher, Make United Decide!
CARRAGHER, ABeg FREE UNITED SMALL!
As United don go back for Baleba and deal fit reach around £70m, Carragher don already start: “He no worth am.” 😭
But when other clubs dey spend huge money on players wey never fully prove themselves, everywhere quiet. Na when United wan spend money suddenly everybody become financial adviser. 😂
If United believe Baleba na the player wey dem need, make dem pay and get their man. Carragher no be United sporting director. Abeg, make everybody mind their business!