02/05/2026
Shebi una don see why we no like Arsenal fans abi?
How Arsenal fans go open mouth talk say if them win the UCL unbeaten, say they go give them Golden UCL trophy. As how nah π₯²
Even Madrid wey use UCL trophy dey behave like say na their inheritance never talk this kind thing, E come be Arsenal wey Diego Simeone fit chase comot for semi final dey yarn this one.
Final una never reach, Una don already dey create the kind trophy wey una go win keh π
Na so them create quadruple give themselves for December last year. Since that time they don follow from quadruple reach treble, still follow treble dey double now. By the time my club Manchester City win Everton 4-0 on Monday and Atletico use penalty shootout comot Arteta and him boys on on Tuesday next week, no be trouble Arsenal fans don enter like that?
Sha E no suppose make wise person dey argue with Arsenal fans when you go fit just wait πππ
Admin 4 in a row π©΅