28/07/2025
EPISODE 2 – The Prestige Wahala 😂💣
So here’s the real gist…
I dey pose for this challenge o, sitting on stool, rocking my bomber short and nose ring.
(That nose ring wey I only wear when I wan enter “character” 😎🎭)
Next thing, my landlord—wey don high small—waka come close, look me from head to toe and ask:
“Where is your prestige?!”
I shock 😳 I say, “Sir? How?”
He point my children wey dey play nearby and say:
“Na you born all these children, abi?”
I still dey look am confused o,
Then he talk:
“You’re beautiful just the way you are. You don’t need nose ring and bomb short to look fine.”
🙄🙄🙄
I tell am, “Excuse me sir, I’m making video. I will send it, and people will see it — no be hidden project.”
I tell am again, “Sir, abeg excuse me! If no be say I dey respect age ehn… I for don woose your face like 3D sl@!”
Then I ask am:
“Are you my husband? Wey you dey ask me all these questions?” 🤨
Na so baba open mouth ask:
“You wan sl@ me?”
Then he just talk:
“Okay. I’m coming…” and waka go upstairs 😩
Now me I dey think:
• (A) Why e dey concerned about wetin I wear or post online?
• (B) Since when e start dey do community monitoring spirit?
• (C) Nose ring and bomb short — does that one really cancel prestige?
Because on a normal day, this man no dey talk to anybody.
Na “Good afternoon madam” and him go waka pass!
So I carry myself go upstairs, tell my husband the matter…
Na the man just look me and say:
“Okay. Stay tuned for EPISODE 3.”
(He don ready to wear singlet and step in 😂)
⸻
Abeg make una follow this gist, because Episode 3 fit turn to reality show 😅📺