Happening & Concept

Happening & Concept Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from Happening & Concept, Digital creator, Lekki, Lagos.

Terrorists  Attack A CAC Church In Kwara StateWednesday Nov. 19 2025.Police for Kwara State, for north-central region of...
19/11/2025

Terrorists Attack A CAC Church In Kwara State
Wednesday Nov. 19 2025.

Police for Kwara State, for north-central region of Nigeria don confam deadly attack for one church for di town of Eruku, wia jaguda pipo bin open fire on top pipo wey gada to pray for Tuesday evening.

Two pipo die for di attack and some odas wunjure - di attackers also kidnap several pipo from di worshippers.

Di attack happen for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, for Ekiti Local Government Are, Kwara state during di church evening programme.

Di bandits shoot di pastor of di church bifor dem round up di worshippers at gunpoint.

For dia statement, di police tok say: "As we search di area, we discover one male victim wey dem shoot die inside di Christ Apostolic Church, Oke Isegun, while we also find anoda victim of fatal gunshot for di bush.

"One local vigilante person also sustain gunshot injury and we rush am immediately go ECWA Hospital, Eruku, for medical treatment."

Police say dia men and di local vigilante pipo don start to search for di attackers wey run enta bush afta dia attack.

Foto and short videos of di attack - wey come from di Church CCTV cameras - don go viral on top social media and e show as di worshippers bin dey struggle to hide wen di gunmen enta.

Di video also show one elderly woman as she dey try desperately to escape di gunmen.

Tori be say at least two of di attackers bin wear face masks to cover dia identity.

Tension still dey high for Eruku town wey dey close to Kogi State as pipo dey fear say di attackers fit come bak.

Eyewitnesses say na three pipo die for di attack wey happun for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, contrary to wetin police tok.

Di eyewitness wey be member of di Church also say di bandits carry over 30 of dia members enta bush. E say dem no fit account to 35 of dia worshipers.

"E happun around 6:00 pm wen dem enta through di fence, dem start to dey shoot guns. Di security man wey dey for di Church dem pursue am, shoot am and e shoot dem back. Dem later kill am.

"Di pipo wey dem kidnap pass 35 pipo, blood stain dey everywia for inside di church.

"We no see security operatives yesterday, even di hunters no fit come becos di gunmen fire teargas.

"Police officers come dis morning but dem no do anything na only foto dem take for di place. Dem carry both male and female, young and old enta di bush."

"Hunters don go search for di pipo wey dem kidnap inside forest,

"Di gunmen use dia leg waka come inside di church wit guns and loot pipo properties wit di bags wey dem bring come."

Anoda source tok say dem pick over 100 bullets shells afta di attack.

A young man, described as a "yahoo boy" (internet fraudster), reportedly tied, dragged, and buried his mother alive as p...
19/11/2025

A young man, described as a "yahoo boy" (internet fraudster), reportedly tied, dragged, and buried his mother alive as part of a money ritual in Benue State, Nigeria. The incident was disclosed by the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Makurdi Zonal Director, Effa Imo Okim.

According to the EFCC official, the incident involved the son taking advantage of his mother's trust during a holiday visit. He struck her with a heavy object, tied her up, dragged her, and covered her with soil in a grave, in compliance with the demands of ritualists.

The EFCC cited this as an example of how the activities of internet fraudsters have escalated from financial crimes to violent acts, including the killing of close family members for ritual purposes. Authorities have advised parents to monitor their children's activities and behaviors closely to prevent them from getting involved in such criminal networks.

A Young Girl Was Killed By Lightening In Benue.A young girl has d!ed after being struck by lightening during rainfall in...
22/03/2025

A Young Girl Was Killed By Lightening In Benue.
A young girl has d!ed after being struck by lightening during rainfall in Mbaiwen, Adikpo in Kwande Local Government Area of Benue State.

It was gathered that the incident occurred on Thursday, March 20, 2025, at the compound of Celina Agbatse, where the victim had gone to fetch water.

As the rain began to fall, she took shelter in front of the house, waiting for it to subside. However, she was struck by a powerful bolt of lightning, suffering fatal injuries. Eyewitnesses immediately rushed her to the General Hospital in Adikpo, but she was pronounced dead upon arrival.

Her body has since been deposited in the hospital’s mortuary.

Address

Lekki
Lagos

Telephone

+2348101554432

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Happening & Concept posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Happening & Concept:

Share