Tori.ng

Tori.ng Exquisite gist 24.7

My country people for inside we tori today,one man just attack one gay couple wey ask am to comot for their bar based on...
15/10/2022

My country people for inside we tori today,one man just attack one gay couple wey ask am to comot for their bar based on say e dey touch touch women for we bar.The man name wey be Cazy Fitzpatrick and e husband Nicholas Ruiz,wey get the bar for Connecticut,On top the same tori,the man come use Anti-LGBTQ words take pursue their customers.
The suspect come attack the gay couple when them they es**rt one of their patron comot from their bar wey dey Connecticut,wey come cause better injuries,for wetin we call anti-gay assault.
Norwalk police come arrest the suspect wey e name na Carmen Everett Parisi,on Wednesday say him commit two counts of assault for the third degree.Now them hold am for Lieu of $75,000 bond.
Fitzpatrick wey be one the owner of the bar,come write say the suspect been dey the bar during a drag show and e dey touch touch women, come dey make the workers uncomfortable. The police officers ecort am respectfully outside, but the suspect no gree comot for doorway.
Naso the suspect come dey violent, come begin punch Ruiz and Fitzpatrick for their throat.E come get when e even punch Ruiz continuously for the right side of him face,wey come cause e cheek to tear and him eye come get injury, the gay couple talk.
Dem come rush Ruiz go emergency room come talk say e need to do surgery of over 50 stitches for him face and eye wey go cost $20,000 for plastic surgery.Na wetin Fitzpatrick talk for him statement be that o.
Fitzpatrick come talk say so far e never hear anything about the case upon say e dey co-operate with investigators and e don go police station many many times. Them come plead with the public to contact Norwalk police.

Address

3, Gbolahan Bakare Street, Magodo Phase 1
Lagos

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Tori.ng posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Tori.ng:

Share