Naija Pidgin Promoter

Naija Pidgin Promoter Naija pidgin na im all of us dey blow for Nigeria. Na im make us be Naija. Na our every every.

The pidgin Class Initiative

Former columnist NAIJA LANGWEJ A-Z (LEADERSHIP Newspaper, Abuja-Nigeria)

NAIJA LANGUAGE NETWORK PRESENTS "NAIJA NA SELENSE"For 2024, di name na - "Naija na Helele" Dis 2025, di name na - "Naija...
24/08/2025

NAIJA LANGUAGE NETWORK PRESENTS "NAIJA NA SELENSE"

For 2024, di name na - "Naija na Helele"
Dis 2025, di name na - "Naija na Selense"

Na conference wey Naija Language Network start for di first time last year for University of Ibadan, Nigeria.

If last year own na Helele and e make sense, dis year own wey be Selense go make over sense bikos, e dey kom with style wey you go like to connect with. Try to register. Di person wey dey invite us na - Prof. Francis Egbokhare wey di whole world recognise for language mata.

Eriata Oribhabor
Promoter, Naija Pidgin

16/07/2025

UNA WAN USE CLUB AND HOTEL FINISH US FOR DIS COMMUNITY?

Auchi investors, you guys can do better. What is happening? Una wan tek club and hotels finish us for dis community? With di way I dey look am now, in the next five years, every street go begin get im own club, just like di way, ehnn, POS full everywhere. Wetin dey sup?

If you go Warake Road, you go see SKJ club, dat one deh dere. If you dey com Orere Junction side, afta Public Field, go front small, ehnn, Mobilux get im own club for dere. If you go straight to Jatu, Club Pressure dey dere, pressurising pipul dere. For inside di same Jatu, Ayo Club deh dere, dem dey do dia things for dere. If you com back for Angle 90, Fashi stand for dere dey wait for you gidigba.

If you go front, you dey go Sabo Police Station side, e get one club wey deh for dere, Underground Club, dem match for ground. Now, if you go further Campus 2 side, Venny Vortex, Club Dreams, e deh dere. Oh! What is happening? Sells and Bolla dem get club. If you go Aviele, dem get club. Igbe Rd, don carry club kom again, weda na Club Toronto, abi na Tolotolo dem call dat club, dat one deh function dere. Wetin dey happen?

And as I dey tok to you now, e get person wey dey watch dis video, e jus dey gada money, e dey gada money, bifor you know, e don open club, e don open Hotel. Wetin dey happen? Development, development, development, na Ashawo una wan tek develop di community? Una wan pack all di whole girls for Auchi put dem for Ashawo work? Prostitutional centres everywhere, prostitutional activities, even girls wey dey do Ashawo, eh eh, Okpilla girls wey dey do Ashawo, now, dem dey come seek greener pastures for Auchi. Auchi, wetin dey happen? At least, mek una bring business enta Auchi, companies wey go dey produce things, even if na fake things, at least, mek e dey produce. By time, una go enta original ones. I neva hear one day sey, dem get one thing dem dey produce for Nigeria, na Auchi di company deh..eh...eh...

_Gi mi da jinja, gi mi da jinja_
_Gi da vibes, we are outside_
_We are outside, we are outside..._

Very soon, na only you and your family members go dey com club bikos, every area go get club now. Abeg, abeg...even di girls wey dey even work for di club, bifor you know, one Aza man go use pen-is sack di girl. E go kom carry di girl put for house dey knack. Club go kom dey find workers. You go go club on Friday, space no go dey deh club, e go be like sey na public field you deh, bikos, difren difren places, club full dere, club full dere. You guys can do better, una kom turn club business to POS. Person just go hussle, gada money, na club e wan invest in. You guys can do better, please. It is not easy. You guys want to improve Auchi by all means but please, we are loosing our wife materials. To even see wife materials for Auchi kom dey hard. Emeyeee? Haa! Abeg oo, abeg...Club and hotels kom surround Auchi di way Fulani kom surround di full Nigeria. Abeg...eh, you guys can do better, please..

Translation:
Eriata Oribhabor
Poet, Author,
- Abuja Na Kpangba & Other poems
- One for Di Road
Promoter, Naija Pidgin

Full video Babafemi Comedy
https://www.facebook.com/share/v/19Hj7LNCs5/

PIDGIN NA WE OWN: ENIOLA LOVE ADEBISI DEY JOIN PIDGIN CLASS INITIATIVE TO TAKE AM TO DI NEXT LEVELBikos we know how e be...
27/06/2025

PIDGIN NA WE OWN: ENIOLA LOVE ADEBISI DEY JOIN PIDGIN CLASS INITIATIVE TO TAKE AM TO DI NEXT LEVEL

Bikos we know how e be before and and how e kom be now for Naija Pidgin Worldwide , Eniola Love Adebisi dey join body with Pidgin Class Initiative to take am to anoda level. She dey reach out to different pipul wey dey promote our Pidgin to see how we all wey dey promote am go dey sabi oursef for di mata.

Eniola na correct promoter of Naija Pidgin wey im social media name na "The Pidgin Influencer" and di kind influence wey she dey attract to Pidgin for Instagram no be here. As 'di Pidgin Girl, wey im be, pipul know am as aka 'di Influencer". Everyday, she dey let pipul know beta beta things about our Pidgin and di power wey e carry for plenti area. Im Instagram page na: -https://www.instagram.com/di_pidgin_inflencer?igsh=OWczdXVyOG4wMWhn

Eniola na 400-level law student wey no dey like mago-mago, dey always stand for front for Naija Pidgin anywhere bikos, na language wey dey bring pipul togeda.

Eriata Oribhabor
For: Pidgin Class Initiative

Today na yesterday future: We dey invite you to attend dis program where we go yan about Naija Pidgin. Abeg, try to atte...
04/03/2024

Today na yesterday future:

We dey invite you to attend dis program where we go yan about Naija Pidgin. Abeg, try to attend or tell someone to attend. Come mek we yan.

31/10/2023

ME AND MY FRIEND

ME AND NY FRIEND na title wey I don give di book wey I don dey write scatter for difren-difren place, even though sey, I don already put some of dem for some of my books. Na Naija Pidgin go plenty pass for inside ME AND MY FRIEND. Dat mean sey, small English go dey inside ME AND MY FRIEND.

If ME AND MY FRIEND enter your hand, you no go wan drop am bikos e go mek you laff and laff but you go pick sense wey you fit use. Everything wey you go read for ME AND MY FRIEND na wetin don happen and no happen between ME AND MY FRIEND.

ME AND MY FRIEND na book wey go carry plenty reality plus sey, Amebo na Chairman wey tek head carry everything. Why i dey write wetin I write so, na to beg you mek you watch out for ME AND MY FRIEND with your full chest. E konsain ME AND YOU plus YOU AND YOUR FRIENDS. Na about YOU and WE, plus WE and YOU.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

28/08/2023

Dat Thing...

tell me something, anything,
dat thing wey be everything
di plenty times and dat thing
wey mek you dey catch fire.

tell me wetin you no wan hear
and di area wey you no dey fear
like water, like river and dia lyrics
how water no dey touch your body.

tell me about you, and your band
from yonda you still hold ground
and dey play well for every land
na your good hand I wan see.

tell me about di top of mountains
and how water tek dey siddon on top
but free me wen we reach di very top
lines g*t chop up with mountain rain.

tell me something, anything
dat thing wey be everything
di plenty times and dat thing
wey mek you dey catch fire.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

18/05/2023

Address

Surulere, Lagos-Nigeria
Lagos

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Naija Pidgin Promoter posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Naija Pidgin Promoter:

Share