16/07/2025
UNA WAN USE CLUB AND HOTEL FINISH US FOR DIS COMMUNITY?
Auchi investors, you guys can do better. What is happening? Una wan tek club and hotels finish us for dis community? With di way I dey look am now, in the next five years, every street go begin get im own club, just like di way, ehnn, POS full everywhere. Wetin dey sup?
If you go Warake Road, you go see SKJ club, dat one deh dere. If you dey com Orere Junction side, afta Public Field, go front small, ehnn, Mobilux get im own club for dere. If you go straight to Jatu, Club Pressure dey dere, pressurising pipul dere. For inside di same Jatu, Ayo Club deh dere, dem dey do dia things for dere. If you com back for Angle 90, Fashi stand for dere dey wait for you gidigba.
If you go front, you dey go Sabo Police Station side, e get one club wey deh for dere, Underground Club, dem match for ground. Now, if you go further Campus 2 side, Venny Vortex, Club Dreams, e deh dere. Oh! What is happening? Sells and Bolla dem get club. If you go Aviele, dem get club. Igbe Rd, don carry club kom again, weda na Club Toronto, abi na Tolotolo dem call dat club, dat one deh function dere. Wetin dey happen?
And as I dey tok to you now, e get person wey dey watch dis video, e jus dey gada money, e dey gada money, bifor you know, e don open club, e don open Hotel. Wetin dey happen? Development, development, development, na Ashawo una wan tek develop di community? Una wan pack all di whole girls for Auchi put dem for Ashawo work? Prostitutional centres everywhere, prostitutional activities, even girls wey dey do Ashawo, eh eh, Okpilla girls wey dey do Ashawo, now, dem dey come seek greener pastures for Auchi. Auchi, wetin dey happen? At least, mek una bring business enta Auchi, companies wey go dey produce things, even if na fake things, at least, mek e dey produce. By time, una go enta original ones. I neva hear one day sey, dem get one thing dem dey produce for Nigeria, na Auchi di company deh..eh...eh...
_Gi mi da jinja, gi mi da jinja_
_Gi da vibes, we are outside_
_We are outside, we are outside..._
Very soon, na only you and your family members go dey com club bikos, every area go get club now. Abeg, abeg...even di girls wey dey even work for di club, bifor you know, one Aza man go use pen-is sack di girl. E go kom carry di girl put for house dey knack. Club go kom dey find workers. You go go club on Friday, space no go dey deh club, e go be like sey na public field you deh, bikos, difren difren places, club full dere, club full dere. You guys can do better, una kom turn club business to POS. Person just go hussle, gada money, na club e wan invest in. You guys can do better, please. It is not easy. You guys want to improve Auchi by all means but please, we are loosing our wife materials. To even see wife materials for Auchi kom dey hard. Emeyeee? Haa! Abeg oo, abeg...Club and hotels kom surround Auchi di way Fulani kom surround di full Nigeria. Abeg...eh, you guys can do better, please..
Translation:
Eriata Oribhabor
Poet, Author,
- Abuja Na Kpangba & Other poems
- One for Di Road
Promoter, Naija Pidgin
Full video Babafemi Comedy
https://www.facebook.com/share/v/19Hj7LNCs5/