28/06/2026
Going to party when you’re still under somebody no be enjoyment… na risk 😭
You go dey dance but your eye go dey turn like CCTV 👀
“Hope say no be my boss cousin be that?” “Who just snap me like this???”
Before you shout “Up NEPA!” finish, dem don send your video reach office group 💀
Monday morning: “So this is where your energy dey go abi?”
Omo… just know say you no go rest 😂
How una dey my people?