
29/05/2025
Loan Apps Dey Your Enemy: Make I Share Sandra Story
Sandra dey into agro-trading business before? But for 2022, everything crash, and she land big debt. Many of her products dem sell for loss, some even thief dem for warehouse. Her foolishness land her for over 6 million naira debt from cashew storage.
Big debt wey de in tens of millions na she de owe. Everything dey fall apart for her eyes. Na d first time wey fear really cash her. she confused completely. People wey she dey owe dey call me non-stop, some even shame her on Facebook.
She sell her land for Ondo State, but na small money wey no even reach 10% of her debt. Pressure dey too much to bear. Her friend advise her make she no borrow more money pay debt, but she no hear na do she go download loan apps, and dem give her good offer. Before she know, she borrow over 4 million naira from loan apps and 2 million from bank.
First, everything dey okay, but as money dey finish, she realize say she dey for big gdese. Money wey she borrow no even reach 40% of her debt, and interest rates high well well. Na so her sufferness start o for year 2022. Two years of sufferness, two years of regret.
Every month, she dey pay at least 550k to 600k for debt repayment. Her sleep dey bad, and she come get high blood pressure for young age. One time, person datch her 1.5 million naira, and before one hour pass, everything do finish on loan apps and bank. But interest rates grow well well, and money no fit break cycle.
She no fit tell anybody about am. she dey rely on her salary and side gigs to survive. When she finally pay all the loan finish, happiness want chok her. When she think about panic, stress, and loss wey she endure for those years, she go laugh and feel sorry for people wey dey fall for same trap.
Loan app ads dey everywhere, dem shiny and persuasive. Dem promise instant funds with no collateral, no paperwork. But dem dey thrive on your desperation. She know say money wey she collect no be solution, na trap.