11/07/2025
Justice for mobad continue
Pt2 cont. from the way SPENDING explains things in the interview he dis with VDM, it’s obvious Mohbad is not surrounded by genuine family/friends. Question(VDM) Answer (SPENDING).
Answer: So as we dey Comot for the show you know say them dey argu* and na me carry Liam, i don even comot clothas we dey go back to island, on 3rd mainland bridge I use my cloth to cover Liam cos the breeze. As we reach island like this CY say she wan come down say she wan go lodge for hotel, say she no wan follow us go house as Mohbad Dey d!stub her and Mohbad Dey talk different different things so she no Dey go house. Darosha and others beg her say shey she wan carry 4months old pikin Dey go hotel? Say make she c@lm down.
As we reach house she vex go up, na me still carry the pikin o, as I carry the pikin reach staircase I just drop the pikin for her say make she dey go up and na midnight everybody don taya na living room I Dey cos I don Taya I no even chop that day.
The next day wa be Monday, Mohbad came downstairs.
Question: so you see Mohbad on Monday?
Answer: yes I saw Mohbad on Monday.
He came down and said, “Omo SPENDING I no follow you dr@g anything yesterday o, Omo no vex na that highness, Omo I don shayo” I spending replied and say “ na my brother you be why you go Dey talk like that I no fit vex for you one love, I Dey with you”. E come talk say primeboy go call him papa say na so him and primboy Dey do, I didn’t know primeboy one on one but have heard about him through Mohbad cos he Dey mention his name in his songs and he say him like primeboy, say na him N.
When he came down starts he said shey na like this him go Dey look him hand? Cos the hand don sw*lll up and he has another show on Thursday. Na small cut o that’s why sef Dey confused and CY didn’t do anything about it she was still dr@gging with him despite the fact him get !nju*y, Mohbad asked if I have someone that can treat him I say omo you know say I no Dey sick I no Dey go hospital. I come tell say make we go hospital, around 11am he come say him no wan go say na who go treat am for house na him he want, I said ok.
I messaged the nurse that same Monday, the message don’t deliver, me and DJ Bami come say make we find alternative say make we find who go fit treat am. Me and Bami comot for house. Earlier when he came downstairs we talked about the video his song he was planning to shoot (Omo mi), as at then nothing do am na only that hand and he still use am open him phone nothing do am. He went back upstairs me and Bami left to find who will treat him.
We went to different pharmacy and they said they don’t do home service but thusly can treat him if he comes there, we told Mohbad he said no he doesn’t want to go anywhere. We bought sp!r!+ and cotton wool Bami was upstairs doing that I didnt go up at all.
Pt3 continues