19/10/2025
Pidgin Report: Regina Daniels Papa, Jude Ojegwu, Yarn How Im No Greet Im Pikin Marriage to Ned Nwoko
Ohhh chai! E don happen o! Regina Daniels papa, Jude Ojegwu, don open up give us tori wey shock person! π² E talk say Regina mama, Rita Daniels, call am "enemy of progress" and even wish am death when e try tell Regina say make e no marry Ned Nwoko, dat 70-year-old man. πββοΈ
Jude yarn say e know from beginning say dis marriage go get wahala. E talk say, "Me wey dey my late 50s, I no fit marry 20-year-old girl. I shame say I dey alive and my 18-year-old pikin go marry man wey old pass me, her papa." π’ When Regina tell am about di marriage, e try advise her say life no be so, and marrying man wey old pass her papa no good. But wetin happen? Regina mama, Rita, curse am, call am enemy of progress, and even wish am death! π³ So, Jude say e comot hand, leave Regina to follow her mind since she don turn adult. E no even go di wedding because e vex well well.
Now, di same marriage wey dem curse Jude for, don dey scatter. Jude say e know say dis kind thing go happen, but e just dey pray make Regina find peace for her husband house. π₯²
Di 55-year-old papa of di 18-year-old Nollywood star, Regina Daniels, talk say e never support di marriage to di 70-year-old Ned Nwoko from day one. Naija people, make una stand up for Regina o! π Wetin una think about dis tori?