Trending with Gifted

Trending with Gifted Giftedhands Ultimate Services | Event Catering Owerri
Stop stressing about food for your event. We cook, deliver, and serve, so you don’t miss a moment.
(3)

Weddings | Birthdays | Office | Church
Call/WhatsApp: 07059630923

What I would tell myself few months agoCaterer, stop dey carry everything for your head alone. If you keep doing everyth...
16/05/2026

What I would tell myself few months ago

Caterer, stop dey carry everything for your head alone. If you keep doing everything by yourself, you go burn out before your business even start to grow. E no dey bad to ask for help. Get one person wey fit help you chop, wash, pack, even if na small work. That small help go save your energy and your head.

You no need perfect plan before you start. Perfect plan no dey exist. Start small with wetin you get, learn as you dey go, and adjust when you see wetin dey work and wetin no dey work. Na so people wey dey succeed dey do am.

And abeg, rest. Rest no be laziness. Na part of the work. If you no rest, your body go force you to rest when sickness come. And when you fall sick, nothing go move. No order go go out, no money go come in, everybody go dey wait.

If you listen to this now and start to pace yourself, few months from today you go look back and thank yourself. Your body go thank you, your mind go thank you, and your business go thank you too.

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

Free tip that got me more replies and DMsStop ending your posts with β€œAny questions?” Nobody dey reply that one. E dey b...
16/05/2026

Free tip that got me more replies and DMs

Stop ending your posts with β€œAny questions?” Nobody dey reply that one. E dey be like homework, and people just scroll pass.

Instead, end with one specific question wey go make it easy for person to answer. Something wey no need long thinking.

Like: β€œWhich part of this dey give you the most wahala?”
Or: β€œIf you had to choose one, you go pick option A or B?”

People dey reply when e feel like quick chat, not like test. Try am for your next post and watch how your DMs go start to move.

Also, stop dey check how many people wey react on your post. Check how many people actually come to your DM and talk business. That one na wetin dey put money for pocket. Person wey go patronise you no go stress you

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

Up and grateful, it's a Saturday. May all our struggles throughout the week bear fruits in Jesus name πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»
16/05/2026

Up and grateful, it's a Saturday. May all our struggles throughout the week bear fruits in Jesus name πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»πŸ™πŸ»

Flourless cake β™₯️β™₯️β™₯️β™₯️Do you know you can Bake  this Flourless cake in 10 minutes for breakfast? Follow πŸ‘‰πŸ» Trending wit...
15/05/2026

Flourless cake β™₯️β™₯️β™₯️β™₯️

Do you know you can Bake this Flourless cake in 10 minutes for breakfast?

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

How to price your service without fearMost people underprice because them dey fear say β€œpeople no go pay" and I'm like h...
15/05/2026

How to price your service without fear
Most people underprice because them dey fear say β€œpeople no go pay" and I'm like how?

But hear me: if you price based on fear, you go always dey tired and broke.

Here’s how I dey do am:

1. Calculate wetin the materials and your time cost you. No guesswork be sure

2. Add profit wey make sense. You dey run business, not charity organisation

3. Remember say the right customer no go run because of price. Dey go run because of value.

Price with confidence. The people wey value your work will pay. The ones wey no go pay, them no be your customer.

Remember everyone is not your customer, do you but dont over do

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

Up and grateful, it's a freaky mekwe Friday.  We return all glory to God πŸ™πŸ»
15/05/2026

Up and grateful, it's a freaky mekwe Friday. We return all glory to God πŸ™πŸ»

Breakfast idea Try new things for the children tomorrow. Check picture excerpts Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted
14/05/2026

Breakfast idea

Try new things for the children tomorrow. Check picture excerpts

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

If you are tired, read thisπŸ‘‡πŸ»If you are tired, e mean say you dey work.  Person wey dey sleep 24/7 no dey feel tired, e ...
14/05/2026

If you are tired, read thisπŸ‘‡πŸ»
If you are tired, e mean say you dey work.
Person wey dey sleep 24/7 no dey feel tired, e dey feel useless.

Tiredness na sign say your body dey try, your brain dey fight, your dream dey move small.
Rest small if you must. Drink water. Breathe. But don’t quit because today dey hard.

The person wey you dey pray to become no get strength pass you. Na consistency dey make difference.
So stand up, even if na slow walk. Tomorrow go thank you.

Oyaa take small πŸ«‚ πŸ€— πŸ«‚ πŸ€—

Be kind to one another, its throwback Thursday. Good morning πŸŒ„
14/05/2026

Be kind to one another, its throwback Thursday. Good morning πŸŒ„

Everyone is just moving maaaaad. I love that the internet never forgets, we will revisit the post in the future when it ...
13/05/2026

Everyone is just moving maaaaad. I love that the internet never forgets, we will revisit the post in the future when it matters. Ishi azu

Today for office na small enjoyment with my colleagues.As a Waawa woman i cooked okpa Enugu for my colleagues, we chop t...
13/05/2026

Today for office na small enjoyment with my colleagues.

As a Waawa woman i cooked okpa Enugu for my colleagues, we chop together and e sweet well. We take am with checkers custard, and that custard sweet well well ooooo, .

We gad fun, I dey showcase small of my culinary arts for office. Everybody enjoy am, and I dey pray say this unity wey dey between us go continue like that.

Follow πŸ‘‰πŸ» Trending with Gifted

Address

Louis Mbanefo Street
Owerri
460242

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Trending with Gifted posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Trending with Gifted:

Share