10/06/2026
GiiiST 👉 I got a call this evening saying they would want me to work with them using my platform for political........... immediately I responded none of my family members dey into politics oh, sir abeg I no dey put body oh, my mama no born plenty I no fit run oh, if them arrest me nobody fit come bail me oh, but if you get political event and you wish for my services either photography or videography book us MRLITEstudio I go come with my team, we go cover very well and we deliver deal close✍️
Any politician wey do well I go appreciate am on GiiiST platform, if you no do well I go close my mouth, e get people wey specialize on yabbing politicians openly and nothing go happen e.g🤐 in fact you see voting and campaigning wey no concern Entertainment abeg no tagg MRLITEtv just post your stuff we go see am🙏 efuuuk 😜
Song by Loveliness Fanz Base