30/12/2025
One day I just dey among my choir members for church, next thing Pastor Chris Okafor call me out say e wan give me prophecy. My mind just open, I no see anything bad inside, so I dey receive am with full heart.
Then e comot the mic, come dey ask wetin dey happen for my mind, wetin I dey think about am. E tell the resident pastor make e carry me go im office. That same day, e give me one brown envelope, say make I carry am go house. Say e go call me.
For 2015, e call me come, say e see vision say I dey date one guy wey be occųlťic man, say make I leave the guy sharp sharp.
E enter im room, bring out 50k plus two apples, come say e like me well well, say make we start to dey date. I come ask am, “But you get wife na?” E say make I forget that one.
Another day e call me again, na that day we first do kiss kiss and sleep together. Na so the relationship take start.
The thing continue like that until belle enter around 2016 or 2017. Na the first preğnancy be that. I call am tell am, e say we go keep am, but two days later e call back say make I go remove am.
We continue again, belle enter again…
– One former choir member of Pastor Chris Okafor don bring fresh acčusati0n against the pastor.