07/07/2025
Ah ah! Wetin person wan explain for this kind matter now? 😭
O boy, you get mind o!
That remaining 1k wey still manage dey my account na im you wan collect join 🤣 my Kobo Kobo savings?
At this point, e be like say insider collaboration dey m. 🤦🏾♂️
Why people no wan allow nature take its course again?
If e never reach your time to blow, calm down.
Your turn go come and it will come clean, cool, and legit.
See ehn, not all wealth is worth chasing.
If money go come with shame, disgrace, or early destruction—abeg, sidon.
Na patience and process dey build lasting success. ✨
God, abeg save our youth from the rush for fast life. 🙏🏾
The pressure is real, but peace is better.
See person pikin like this… chai! 😢
God, please… may we not raise or become a public nuisance.
May our success be loud but clean. May our names be great but honourable.