07/01/2024
Balenciaga...
No be the day pikin break plate im dey collect,
No be for express dem dey do 'I can drive;'
Pikin wey say im mama no go sleep na premium ogbanje,
Nobody fit stop you except that bobo wey dey mirror.
Wetin pale dey see when im sidon,
Junior too fit see am if im shine im eye wella;
No dull o, success no be anybody birthright,
Just do your best, baba God hold im side already.
As you lay your bed, no be so you fit meet am,
A stitch in time, na better tailor amend am;
All die na die but the koko na where you end up,
No play oh, eternity too long to carry dey joke.
You fit wear Balenciaga make your life still no balance,
First class no be by who collect extra sheet;
This year, work smarter not just harder,
The bottom line no be how far but how well.
Person wey get money no dey answer Hope,
But no fear, tommorrow get belle and na twins im carry;
If e sure for you, show your guys way,
One car, no matter how im long reach, no fit form convoy.
Eye wey see today fit no see tomorrow,
Every new day na privilege, you better make it count;
Joy fit still come for night if you align well,
Na still condition go make crayfish straight.
The journey of a thousand miles begins with enough tp,
'Police is your friend,' na so station take dey full;
Who no guide him side no dey follow drag land,
2024 go deliver for you, but you gats first give am belle.
©