05/01/2023
copied
Make una follow me laugh.
Immediately my husband and I arrived village for Xmas everybody were happyooo but them come begin de do backyard meeting, I come suspect say na ontop my head them do all that meeting I no talk,I no shake cause I know say my Grace de very sufficient, I come de mark them like one good player wey wan collect ball from person leg, finally I come hear my sister in-law and co wife de plan how them wan use me like 10/11 spanner 🤣🤣 I no even talk, I enter inside go tell my husbandooooooo
Me: Best shebi I don talk am say na ontop me, your wife head them de do all this meeting for ni, I don hear your elder sister and your brother wife de talk say them go attack my bad character,say na me go de do boi boi for all of us 🤣🤣🤣🤣
Hubby: busy pressing phone didn't say anything
Me: Best have you heard ni abi the phone is more important than my talk abi?
Hubby: noooo haaaa how can phone be more important than my yeye wife, I was searching jumia to see if they have peace for sale make I buy for u 😂😂 u too like wahala.
Me: Thunder fire you, u no know say peace de comot me rashes for body? No try amooo else thunder will fire both you and who de sale the peace🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
Hubby: laughing and clapping
Me: see this one you no tell them say na mad woman u marry? Shebi that first day wey u see me for road you no look my hand see nylons wey I do pick ni? Na craze I craze I no kill person 🤣🤣🤣mad woman husband.
Hubby: them no even Sabi uoooo Efcc abi Dss de learn work for you hand, now now you don investig*te them g*ther facts and evidence 🤣🤣🤣🤣🤣
Me: you no well shebi na me come tell you na,abi u follow for weapon formed against me for this una family house abi? No worry e go soon clear una na
Hubby: ok how do we handle this without having to fight or quarrel with anyone especially mama
Me: you go support your wife abi? 🤣🤣🤣🤣Chai see mumu wey de support wife leave family, u carry this marriage seriouslyooooo🤣🤣🤣 for better for worse Don drunk uooo
Hubby: u be the B thing wey happen to my lifeooo I de hold de marriage with two hands 🤣🤸till death
Me: B thing? B for Bad or B for best talk am nowooo no cut corners 🤣🤣🤣🤣🤣🤣
Hubby: B for Baaaaddddd🙄🙄🙄🙄🙄🤸🤸🤸🤸
Me: u wan cry,see ehhhh tomorrow morning I hear say na me go cook rice for everyone so I go do wife material wake up very early enter kitchen cook I go hide dish our own food come keep the pour salt plenty for remaining them no go ask me to cook again, but you have to be supportiveooooo🙄🙄 make them no kill me with cooking 😂😂😜😜
Hubby: blood of Jesus, who are you in this body come out before fire consume you 🤣🤣🤣🤣Best u baaadddd I swear so u know say if u cook salty food them no go send you to cook again 😂 chai legally married demon 🤣🤣🤣
Me: Johnson stop naa I would gladly cook but I don't just like the fact that they made it look like an attack or hatred, if they told me directly that our wifeoooo you will cook for us tomorrow I for do am but they came in vawulence and vawulence shall they see🙄🙄 just be a supportive husband to me just once, let's do this evil and buy our freedom 🤣🤣🤣
Hubby: you get confidence for this ur jujuoooo🤣🤣🤣🤣chai I don marry wetin pass my power, wify of the most high 🤣🤣🤣I am loyal ma,I marry my wife no be family wife abeg🤣
Me: na now u talk like who I don work on him coconut head🤣🤣🤣🤣 my for better for worse partner 😂 no worry I go free u one bottle 😉
Hubby: give me nowooo no be later u go mad forget am🤣🤣🤣🤣
Me: e go bad say I break your leg for your family very before 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣(we got laughing and I left the room)
Early morning the following day I entered kitchen before 8am food don ready I carried out my task as planned, not long I saw them whispering I knew it was the food I acted like I knew nothing, then my mother inlaw called me and I went she asked y I made salty food and I told her I was sorry she started shouting at me but I kept saying I was sorry then hubby came and asked why mama was shouting at me and mama ended up saying I can do other things but not cooking 🤣🤣🤣🤣that my co wife cooks better so she will handle the cooking 😉😂 miracle no de tire oga Jesusoooo I don use sense fight first battle winooooo make I follow my husband go celebrate abeg🤣
Hubby: madam u be baddest I no even know say u don get witch ni u were saying mama sorry as if u knew nothing 😂😂 devil Don catch meoooo e use u catch me Makachi
Me: I am free from cooking for 8children 14 grandchildren and 4 daughter in-laws ni if u like call me wateva e no concern meoooo🤣🤣🤣🤣devil support system like you.
@ Ndiana paul