Areaboyz comedy house

  • Home
  • Areaboyz comedy house

Areaboyz comedy house A Media/news page that will keep updating about happening and events within and outside Nigeria

30/01/2025

Former presidential candidate and activist Omoyele Sowore go remain for police custody till Thursday wen im case go continue.

Nigeria police arraign Sowore for court on top accuse of cybercrime.

Dis arraignment dey come days afta police invite Sowore for di Force Headquarters for Abuja, sake of video wey e publish for im X handle wia e refuse to stop for policemen for one checkpoint for Lagos.

As Sowore go ansa di police summons, e later post for social media say di police don grant am administrative bail but e reject am.

According to am, di bail condition na for am to deposit im travel passport and also bring one surety wey go be a level 17 civil servant wit property for Abuja.

“I don reject di bail conditions and I chose to remain for detention,” Sowore bin write.

As e be now, di police don sama Sowore wit a 16-count charge wey concern cybercrime.

One of di counts tok say Sowore dey spread false information against di Inspector General of Police “wit di purpose of causing breakdown of law and order”.

Sowore plead not guilty to di charges.

Di matter dey bifor Justice Musa Sulaiman Liman of di Federal High Court Abuja.

Di case dey adjourned till Thursday, 30 January 2025 by 1:00pm for ruling on bail.

16/09/2022

Only ✌️ more days until the season opener! 😄

12/07/2022

Address


Telephone

+2348077322582

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Areaboyz comedy house posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

  • Address
  • Telephone
  • Alerts
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share