Nigerian Celebrities News In Pidgin

  • Home
  • Nigerian Celebrities News In Pidgin

Nigerian Celebrities News In Pidgin ⛔️ Nigerian celebrities Affairs
⛔️ Lifestyles
⛔️ Wealth
⛔️ Families
⛔️ All translated in pidgin

I know say wetin de happen for Nigeria don make some of us no de quick remember things again ooo, As I wake up, I come r...
15/03/2024

I know say wetin de happen for Nigeria don make some of us no de quick remember things again ooo, As I wake up, I come remember say e get our biggest celebrity singer for Nigeria wey im birthday na today,no be only him sef,e still get this lady wey be linda ikeji sister,she self, still de celebrate today..

Omo e come be like say today go sweet for people wey go dey around them ooo..

Eheee before I go forget, I know say una don de wait tire make I mention these important people wey de celebrate their birthdays today..
Una know them nauuu, if you go still Google am,Google go still give una de expo 😀

Well, as i just de happy today,make i kukuma give una de expo,no time to check time bro....Na Olamide and Laura ikeji..
No tell me say you know no them ooo, 🥱

Olamide na im be the boss,even the owner of this music label YBNL and Laura ikeji be the younger sister ,Linda ikeji wey be the highest blogger for nijuria..

Abeg my fellow Nijurians,make we celebrate them,even if food no dey to chop today,data go dey nau😊
Make we just wish them Happy birthday, make them still know say them get person no be for mouth 😊

Abeg ,I go leave una here go drop my pikin them for school jare,I try abi I no try to remember una say your fav de do birthday today😊

I go see una for the next tori....Chaoo😍😍

Address

Allen Av, Ikeja

Telephone

+2349133187367

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Nigerian Celebrities News In Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Nigerian Celebrities News In Pidgin:

  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share