10/01/2025
So yesterday I got a call that i needed to be in school for an impromptu test, at first I was like "which kind test again, omo i don taya ohh "but I just maintain my steeze package myself went to take my bath, after bathing, time to dress gannnn I wore my clothes, left for school, but something happened immediately I entered school like this ehhh I noticed that most of my course mate were just starring at me some were smiling at me and I didn't know why they were smiling at me but me self follow smile ππππ.
My head just con dey big, then all of a sudden my friend came to me and said "ahhh Efe abeg we get presentation today ?" immediately I stopped smiling and asked him "I don't understand what do you mean" at that moment I was scared presentation ke abeg ohhh I noticed the shock in his face and he asked again "where u dey come from abi you get conference meeting" this time I pause and ask him why all these questions and he replied "ehhhhh you are looking too serious see as you dress ever since I know you, you never dress like this come school before na always Crocs, jean and polo, u nor even dey comb hair self ah ah wetin dey happen" omo when this guy talk finish I wan cry πand I replied him "I nor blame you rara see ehhh I wan dey dress co-operate from now" this boy started laughing at me ohh And he said I was making him look like he is not serious πππ that after three days I will stop I told him it ok let see who will win.
This boy dey follow me play, even for hot sun I go wear suit, yes I will wear it, e nor get wetin anybody wan tell me. Even if I bin nor serious before I don dey serious, this guy don make me vex.