Owan Voice

Owan Voice Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from Owan Voice, Media/News Company, No: 9 Ukhuekhue Qtrs, Saboggida-Ora Road Off Saint Joseph Catholic Church, Eme-Ora, Owan West LGA, Kuje.

📢 Breaking News & Current Affairs
🎙️ In-Depth Interviews & Analysis
🌍 Cultural & Community Stories
📺 Entertainment & Lifestyle
⚖️ Advocacy for Progress & Development

📩 Contact us: +2348073501213, [email protected]
🌍 www.owanvoice.com.ng

03/03/2025

Please follow our WhatsApp Channel

BREAKING DEM DON KIDNAP UYI JENNY EBOHON FOR EKPOMA, EDO STATEE just reach our table say one babe wey dem call Uyi Jenny...
02/03/2025

BREAKING DEM DON KIDNAP UYI JENNY EBOHON FOR EKPOMA, EDO STATE

E just reach our table say one babe wey dem call Uyi Jenny Ebohon don miss as kidnappers carry am from her house for Ekpoma, Edo State last night.

Di matter serious because 11 hours ago, one post show for her Facebook wey dey ask for help, and since den, family and friends never hear from am again.

We never sabi whether her family don report di matter give police, but as society, e dey our hand to make sure say we amplify dis cry for help.

People wey dey comment for her timeline talk say she get one small pikin and e still dey nurse 18 months old baby girl—we must bring their mama back!

I don already forward dis info give some officers for Edo State Police HQ make dem shine eye put. But we need all hands on deck to find her.

Abeg, make una share dis post well well!

Who Go Pay Who? Akpabio Wife Wan Collect ₦250B, Natasha Still Dey Find ₦100BWife of Senate President, Madam Unoma Godswi...
01/03/2025

Who Go Pay Who? Akpabio Wife Wan Collect ₦250B, Natasha Still Dey Find ₦100B

Wife of Senate President, Madam Unoma Godswill Akpabio, don vex go court say Senator Natasha Akpoti-Uduaghan don give am headache wey e no fit drink Panadol for. She dey demand ₦250 billion for damages plus she wan make Natasha apologize for newspaper make di whole world see.

Dis gbege start when Natasha yarn for Arise News say Akpabio don harass am before, and say na because she no gree for am, di wahala start. Madam Akpabio no gree o! She say di talk don scatter her name, spoil her family rep, and give am serious emotional wahala.

Now, she wan make Natasha do public apology for The Guardian and ThisDay newspaper, plus she dey find ₦250 billion for "fundamental human rights violation" and another ₦1 billion for defamation.

But na here di matter sweet pass—Natasha sef don first carry Akpabio go court before, say e don spoil her name, and she dey find ₦100 billion from am.

So, who go pay who first? Na di real “agbado no be beans” case wey we dey watch. More tori dey come!

DIBIA BY DAY, PASTOR BY NIGHT – WAHALA DON BURST!Wetin we no go see for Naija? That native doctor wey go viral after e b...
28/02/2025

DIBIA BY DAY, PASTOR BY NIGHT – WAHALA DON BURST!

Wetin we no go see for Naija? That native doctor wey go viral after e baff Yahoo boys with unknown bl00d don finally cast! Guess wetin? E be pastor for Port Harcourt!

So na Dibia for Abia, Pastor for Rivers. The question be say, wetin e go be for Enugu, Anambra, Imo, Ebonyi, and Delta? Bishop? Imam? Chief Priest? Abi e get another surprise for us?

This kin double hustle no be here! Many people don dey reason say na wetin dey make church and shrine full everywhere for Naija.

Wetin una think? Drop comment!

Wahala for Uzebba! 😳🔥Emiemi don kpuff junior pastor wife after she confess for her s!ck bed say senior pastor dey doke h...
27/02/2025

Wahala for Uzebba! 😳🔥

Emiemi don kpuff junior pastor wife after she confess for her s!ck bed say senior pastor dey doke her! Church matter don turn another thing for Uzebba. Oyeeee!

Details coming soon… Stay glued!

?

BREAKING: EDO STATE DON PASS ONE OF DI TOUGHEST ANTI-KIDNAPPING LAW FOR NAIJAEdo State Governor, Sen. Monday Okpebholo, ...
27/02/2025

BREAKING: EDO STATE DON PASS ONE OF DI TOUGHEST ANTI-KIDNAPPING LAW FOR NAIJA

Edo State Governor, Sen. Monday Okpebholo, don sign di Kidnapping Prohibition (Amendment) Law 2025, wey go make sure say Edo no go dey safe for kidnappers again.

Di new law talk say any kidnapper wey dem catch and convict go face death sentence. Plus, any house, hotel, or property wey dem use do kidnapping go demolish am sharp sharp.

Gov Okpebholo yan say dis one na bold step to wipe crime comot for Edo, and make sure say everybody wey dey Edo go fit waka free without fear.

Di law don cause big talk everywhere as pipo dey hail di governor say e mean business, and e no wan hear say criminals dey do anyhow for Edo State again.

With dis new law, Edo don join di states wey get di strongest law against kidnapping for Naija.

Women Dey See Shege for Marriage! 😭E truly no easy for many women wey dey do everything just to keep their marriage. Som...
26/02/2025

Women Dey See Shege for Marriage! 😭

E truly no easy for many women wey dey do everything just to keep their marriage. Some dey endure suffer, some dey fight silent battles wey nobody fit see.

If you get responsible husband wey dey try, thank God o! 🙏 Many women nor even know wetin be peace for their home.

?

INTER-HOUSE SPORTS COMPETITION – SPECIAL INVITATIONOya, make una mark the date! Big sporting action dey come for Okpokhu...
26/02/2025

INTER-HOUSE SPORTS COMPETITION – SPECIAL INVITATION

Oya, make una mark the date! Big sporting action dey come for Okpokhumi-Emai as Elim G/S go host their Inter-House Sports Competition.

Date: 14th March, 2025
Time: 12PM prompt
Venue: Elim G/S New Site, Upper Eguakhide Street, Okpokhumi-Emai, Owan East, Edo State

Come witness strong competition, talents wey go shock you, and plenty fun moments. Your presence go mean plenty for us, and we go appreciate am well-well.

For more info, call:
📞 08132984499 | 07032553965 | 08165592732

Make we celebrate sports together!

Edo Gov Okpebholo Don Sign New Law – Death Penalty For Kidnappers, Demolition Of PropertiesEdo State Governor, H.E. Sen....
26/02/2025

Edo Gov Okpebholo Don Sign New Law – Death Penalty For Kidnappers, Demolition Of Properties

Edo State Governor, H.E. Sen. Monday Okpebholo, don sign Kidnapping Prohibition (Amendment) Law 2025 wey go make wahala tight for anybody wey dey do kidnapping for Edo. This new law go make sure say Edo people dey safe and criminals no go get breathing space again.

Wetin Dey Inside The New Law?

1️⃣ Death Penalty For Kidnappers:
Anybody wey police catch, wey court find guilty say e kidnap person, na straight death sentence. No mercy for people wey dey put fear for people body.

2️⃣ Demolition Of Kidnappers' Properties:
Any house, hotel, or camp wey dem use do kidnapping, na straight demolition! Edo State Government go seize am, pull am down, finish work. No hiding place for criminals again.

3️⃣ Accomplices Go Collect:
Anybody wey help kidnappers – whether na by giving information, providing shelter, or collecting ransom – dem go still face death sentence, and all their properties go turn government own. No space for backdoor escape.

Gov Okpebholo say this law na part of him Practical Governance plan, wey no be just to dey talk, but to take action wey go show say Edo don change. He say security must dey, so that business go grow, life go dey better, and Edo go shine.

Wetin you think about this new law? Drop your mind!




Sharia Council Para for Tinubu-Shettima Muslim-Muslim Ticket – Say E No Benefit Muslim CommunitiesKasala don burst as Sh...
26/02/2025

Sharia Council Para for Tinubu-Shettima Muslim-Muslim Ticket – Say E No Benefit Muslim Communities

Kasala don burst as Sharia Council don express big disappointment for how things dey go under Tinubu-Shettima government.

Di council talk say many Muslims, especially for Yorubaland, bin believe say di Muslim-Muslim ticket go favour dem, but e be like say na pure cruise dem enter!

🔹 E be like say di promise no reach ground?
🔹 Why e be say di people wey support di ticket no see di "benefit" wey dem expect?
🔹 Muslim-Muslim ticket na scam or na patience dem need?

Drop your thoughts for comment section! 👇🏾

TINUBU G*T TO PARDON KEN SARO-WIWA & OTHERS, COMPENSATE DIA FAMILIES – CLEAN FOUNDATIONClean Foundation don tell Preside...
26/02/2025

TINUBU G*T TO PARDON KEN SARO-WIWA & OTHERS, COMPENSATE DIA FAMILIES – CLEAN FOUNDATION

Clean Foundation don tell President Bola Tinubu say e no go bad if e grant state pardon to late Ken Saro-Wiwa and di other Ogoni 9 wey military execute for 1995. Dem say di mata na big injustice, and di families wey suffer suppose see compensation.

Di killing of Ken Saro-Wiwa and hin people na one of di biggest human rights wahala wey don happen for Naija. As Tinubu dey yan reconciliation, many people dey expect make e correct di wrong wey don happen since.

You feel say di pardon go make sense? Or e don late? Drop your talk for comment!

26/02/2025

Edo Gov’t No Dey Joke Oh, Dem Don Open New Security Outfit Land with Fresh Hilux, Show of Force Self Don Start

Edo State Governor, Senator Monday Okpebholo, don launch new security outfit wey go scatter criminals for di state. As e launch di team, e pack over 50 brand-new Toyota Hilux patrol vans join body, make sure say security go tight well well.

No be mouth, di new security team don already begin Show of Force for Benin City and other key areas. Dem full ground with police, army, DSS, NSCDC, and other security people, dey march through di major roads to show say wahala no go get space for Edo again.

Senator Adams Oshiomhole, wey sabi di matter well, hail Governor Okpebholo for dis strong security move. E talk say di new Hilux go help security people waka fast, land for any gbege place quick, and make sure say criminals no go see road run.

Edo State Commissioner of Police, Betty Enekpen Isokpen Otimenyin, sef confirm say dis new security arrangement na better plan. She talk say di Show of Force na just di beginning, say Edo people go see beta action against anybody wey wan do anyhow for di state.

With dis new security wahala, Edo people go fit sleep with two eyes closed, as di new team don land gidigba to protect lives and properties.

Address

No: 9 Ukhuekhue Qtrs, Saboggida-Ora Road Off Saint Joseph Catholic Church, Eme-Ora, Owan West LGA
Kuje
313109

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Owan Voice posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share