15/10/2025
As e don dey official say we don qualify for African 2026 FIFA Worldcup qualifier Play-off make una get ready because we don move from Mathematics to further Mathematics..
• We go dey four teams wey go play di African play-off and di teams na Nigeria, Gabon, Cameroon and Burkina Faso or DR Congo and di play-off go shele next month for Morocco..
• Any team wey win di African play-off go come qualify for another play-off wey dem dey call “ six team intercontinental play-off” .
• Dem go play di intercontinental play-off in Mexico and e go start next year March..
• Teams wey we go meet their na 🇧🇴 Bolivia, New Caledonia 🇳🇨 , two teams from Central America and one from Asia.
• Inside that Intercontinental play-off, e get wetin dem dey call Seeded teams and unseeded teams( Seeded teams na higher ranked teams in FIFA world ranking while Unseeded na lower ranked teams).
• So dem go divide two 6 teams into two groups, 3 teams per group ( 2 unseeded teams go play semi final anyone wey win go meet seeded team for final).
So di two teams wey win their group go qualify for 2026 FIFA World Cup..
Via : Football in Pidgin