09/26/2025
Breaking News 🤦♂️💔
VDM why you dey do like this? I’ve always supported you but this time I no gree.
Ashmushy say she wan teach Nigerians how to make hundreds of millions from media with just 36k, and you dey fight her? That one no good at all.
But wait oh… if I pay 36k, I go learn how to make hundreds of millions? For just 36k? 🤔 Ashmushy wey don already dey make these millions still wan collect my 36k? She love me like that? 😂
Anything wey promise you quick millions, run! 🚩 Na so Ponzi dey start: “invest 10k, get 100k in few days.” Look at that flyer sef—so many things packed inside, and dem say dem go teach all that in just one week? Na pure scam vibes. You can’t grab such skills in a week, and even if dem show you basics, you no go turn millionaire overnight.
Moral lesson: After this class, we dey expect to see millionaires everywhere. If dem no hold one “crypto guru” and one “masterclass coach” teach them lesson, others no go ever learn 😂