03/13/2026
Hmm! Before you buy laptop
E go be like say na that laptop
Be the only thing standing between you and billions
You go dey talk am with confidence o
āIf I just get laptop eh⦠my life go change" here and there
You finally buy the laptop...
FIAM!!!
Laptop don turn Netflix branch office.
In the morning...film oooo
''I go begin tutorials in the afternoon"..chakam!!!
Afternoon don come,
Oya begin tutorials nau
YouTube Movies (all dem Clinton, Maurice and Uche Montana movies, only you don watch am finish.
Even follow dey wait as dem dey record new movie make u dey first 1000 people to watch) hian! Film lord...oya take your crown
Night have reach,
let's learn a skill nau...
na phone u dey use am charge like power bank pro max...
Meanwhile the money wey suppose enter account still dey ask
āaunty, you never start work?" Oluwa o
If you get laptop wey na film and power bank you dey use am do, abeg bring am come.
Make I show you how to use that same laptop take make money online. š
Moral lesson: check out my outfit, it's giving ba?