BBC Bayelsa

BBC Bayelsa Hard and soft news within Bayelsa and its environs for the people of Bayelsa. ..

16-YEAR-OLD BOY, AYIBANUA TIMIPRE, DON COMMIT SU!C!DE FOR YENAGOA One 16-year-old boy, Ayibanua Timipre, from Igbomotoru...
16/02/2025

16-YEAR-OLD BOY, AYIBANUA TIMIPRE, DON COMMIT SU!C!DE FOR YENAGOA

One 16-year-old boy, Ayibanua Timipre, from Igbomotoru Community, Southern Ijaw Local Government Area of Bayelsa State don commit su!c!de as him hang himself with ceiling fan.

People wey dey live for Jasmine Suite Road, Kpansia community wey the thing happen, say them still dey shock because of the matter.

They said Timipre hang himself with ceiling fan for him papa house, and the rope still dey for the fan after dem remove him body.

Although, the reason why Timipre take him own life, people never know why, some people for the area said may be him papa and mama punish am because say him thief 27,000 naira from the house.

Others said Timipre na very cool guy wey people like well-well and wey learn mobile mechanic work for the community.

Rhythm 94.7fm report say police officers done go remove Timipre's body for the place.

One of him uncle wey help carry the body enter the police motor, talk say Timipre just celebrate him birthday wey make am 16 years on Sunday, but no put mouth on top wetin happen.

Address


Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when BBC Bayelsa posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

  • Address
  • Alerts
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share