24/04/2025
Na you carry babe for night, me I no carry.
Na still you text me for midnight whether I fit come outside.
I asked you; whether make I bring condoms come for you? You said NO, say something dey occur make I show for generator side.
I asked you, whether the babe die for your house? You said NO, say make i come first.
As I no too understand the pattern I fess carry metal with 12 rounds shook for waist, come wear man-U jersey take cover am. I meet you for gate where you wear only boxers and you dey shiver like old man wey get diabetes.
I ask wetin sup.
Baba tell me say him dey feel say the babe wey him carry na snake. I ask am how, wetin he mean by that. Baba say once they cuddle, e go be like say plenty hands want strangle am. Or e be like say one big round rope wan squeeze am.
I first laugh 😂
But this guy no dey joke. Normally na strong man for area wey boys sef dey respect. He say make i allow am sleep for my side till daybreak.
Na my guy, I no fit loose guard am. But I just dey laugh am dey go. I ask am wetin him go tell the babe, he say him don tell am say him guy need help, say he wan go help am.
Me I no need any help oo 😂
Na you need help from snake.
I come dey tease the guy say - what if the babe wan give you snake in the monkey shadow 😂
As I dey yab am, we dey stroll go my staircase to climb up, out of nowhere - two snakes ran from generator side towards my staircase.
I quickly pulled out my divers and off one snake, the other one run escape from backyard.
Na so my guy and I run enter upstairs lock everywhere, lock staircase too. All those jokes wey been full my mouth clear asap.
Strong man like me, I run enter my room go begin find the Bible wey my mama Nwanyị WATCHMAN give me many years ago wey I no dey open. Na so me and my guy - two strong men begin read Psalm 23 and Psalm 121 around 2am.
We begin pray. My guy dey speak in tongues nai'm I burst laugh 😂😂 my guy asked me wetin sup, I ask am: baba no be this same mouth wey you use suck vaj