13/08/2024
I remember when I visited a friend back in the university. He invited me over to come over to his place and play the then popular play station game.... basically to have fun.
I got there and noticed he invited my crush, Sharon. Me wey been dey vex say he no tell me say na plenty people dey come, the vex immediately change to joy cos of my to-be babe. I finally got the chance to approach her.
Unfortunately the joy changed to sadness abi disappointment when I found out she wasn't just in a relationship but the werey boyfriend follow am come.
I always thought she was single. Ah, this thing vexed me. I chop breakfast from person wey I no dey in relationship with.
Anyways I maintained composure and steeze but deep down I dey wail like baby.
While they had fun and I mourned, my guy put on the PS2 game and it was time for guys to play football.
Sharon's boo collected pad and another guy collected the other pad. The rule na the usual rule, Loser drop pad. If you lose, you give the pad to someone else. Dem set the time to 3mins per match
They started playing and at the end, Sharon's babe won. The next person entered and he won that person too. Solomon entered, dem beat Solomon too. Ahh!! No be even small small beating ooo, na 5:0 and 4:0 Baba dey win them. Na so he Sabi reach?? Even person wey get game, he win am too.
I saw Sharon smiling and pecking him and I got angry...e con be like say this anger motivated my style of play. I collected the pad and sat down to play next. He dey smile dey look TV, Sharon dey massage hin neck. If I no disgrace you in front of this girl today!!!
He chose Barca and I picked Dortmund. "Abeg ooo, take am easy with me ooo", he said while setting formation.
Be like the werey really Sabi play ooo cos na so dem dey talk. I sha laugh and reply "Ah, bro na you suppose pity me o". We laughed....Baba no know say I carry for mind like this.
The game kicked off and for first half I deal with am wetin no good. For every goal I scored, everyone inside the room shouted "Eeeii!!" "Ahh!!" "Omo!!".... E get one wey I dribble keeper, come back, pass the ball to hin player, collect am back and score... everybody shout "Ahhhhhh".
I paused the game and laughed out loud. First half finished and I was already leading 6:0. Laugh now na, werey. Shine your teeth, ewu. Ah, Sharon dey massage hin back na, nonsense. Baba body just cold and my own body dey sweet me.
Second half kicked off and I added another 4 to make it 10:0 then I con make sure say Baba leg no touch ball again until match finish.
After match, he dropped the pad, we shook hands, I con dey tell am "Nice game bro, nice game. Thanks for pitying me". Baba look me smile con shake head.
To talk hard am. The beatlng render am speechless. My body sweet me that afternoon. He left shortly after with Sharon. It was very embarrassing.
Everyone then rushed me and was hailing me. My head sef con dey big. "Guy you get mind oo!! Where you belong??" They said while praising me??
"Na Jesus help me ooo" I said while laughing.
"Guy!! I no know say you don belong somewhere ooo...cos na person wey belong, fit beat Ejima Jesus like that boldly." Timothy said while we were preparing to play the next round.
"I no understand. Na normal game na. Who be Ejima Jesus "... At this point, my laugh don dey crack small small.
Immediately, one guy with one eye entered the room and tapped me "Bro hwfa, Pilot say make you lap outside small. He dey call you."
"Ah, Pilot ke? Me na mass communications I dey study for school ooo, I no be Aeronautics engineer."
Baba showed me axe and repeated that Pilot was calling me. Na there my brain con fast forward everything back for me. No wonder he been dey win people before, na cultist babe I dey crush on.. I beat Pilot 10:0 for hin babe front.
Now Pilot don summon me. Me wey be aspiring journalist.
Omo after I go answer Pilot that night, the next morning for school, Sharon met me in class; "Steve, I heard what happened last night. Please don't mind my boyfriend, he's a siIIy boy! Come with me, I have to warn him not to try such unless I'll leave him!...let's go"
Me: