16/04/2023
Gist way we be postam few hours ago about dat die-body way dey digam for Bamenda, cut the hand dem... update dey!
Police don catch di👇guy for di picture, way wear dat line-line triko, say na e do the act...
How dey catch e?
As caffiage discover the tin for morning time, dey go report for police... Police open investigation, na so dey catch e...We hear say dey catch e wit the die-man e 2 hand dem, inside some bag...
Na who be the die-man?
Dat die-body way dey digam so, na the die-body of some ELECAM worker way dey be shoot e for Foncha street Bamenda, earlier dis year, just before elections be wan hold... we be langua una the tori, hope una di memba...
Why dis👇Sango go dig e grave?
Time way dey catch e, e tok say dey pay e 500,000frs for go dig dat grave, cut the die-man e hand dem...
E say the pipo dem way dey pay e for go doam, dey be complain say the man e spirit di worry dem.
Wheda dey geh hand for the man e die o, na dem sabi... bicos weti be the reason why the man e spirit go di worry dem?
Anyway,
E show say dey be go consult dier ngambé and dier ngambé teh dem say the solution na for go dig the man e grave, cut e hand dem...and e spirit go stop for di worry dem.
Since dey no be fit doam dem se-sef, dey pay dis👇guy 500,000frs and e doam...
The guy dey ngata now so, for Upstation Bamenda, di warm space for dey... while investigations di kontinu...
Source