19/12/2025
December don land, and na that time wey everybody wey dey stay far dey rush go village go see papa, mama and family 🎄✨
No wahala, Christmas sweet… but abeg make una shine una eye well well.
This period kid #^pping plenty for road, so travel with sense.
May God protect everybody wey dey travel, go and come back safely 🙏🏽
Another thing be say… abeg no go borrow money because you wan go do December show-off for village.
My brother, my sister, if money no dey, money no dey 🚫💸
No go borrow money go impress people wey no even send you.
No be every December you must prove say “I don arrive.”
No go show old school mate say you hammer, meanwhile na loan you take hammer 😭
Because when you come back January,
na you go dey do hide and seek with debtor —
today you hide for toilet 🚽,
tomorrow you hide for uncompleted building 🏚️🤣
Abeg live within your means.
Peace of mind pass December cruise.
Make we enjoy small, make we safe, make we no carry problem enter new year.
God dey 🙏🏽❤️