
17/09/2025
One court for Ghana don sentence popular TikT**er David Kwodow Prah Afful, also known as “Kwame Nkrumah II,” to seven months in prison.
Dem find am guilty say e incite violence. E bin allegedly threaten to kill President John Mahama and members of Parliament inside one viral video.
Mr. Afful bin don dey face trial on charges of offensive conduct to breach of peace wey im bin plead guilty to.
Di police investigator wey handle di case Seth Sewornu clarify say dem convict am on di breach of peace conduct charge, but e still dey stand trial for di death threat.
Inside di video, Afful bin allegedly threaten to kill govment officials, journalists, and civil servants using official vehicles.
E bin also threaten to burn marketplaces and encourage odas to do di same and say im go take responsibility for dia actions.
Di police for Ghana explain say dem no dey against freedom of expression but dem no go tolerate statements wey incite violence.