10/04/2021
JAMB 2021 registration date, UTME accredited centres and oda tins you need to know about dis year exam
Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) registration no dey start on 8 April 2020 again.
Di Public Relations Officer of di examination join-body, Fabian Benjamin confam dis tori to BBC Pidgin say dem still dey put somethings in place to make di registration process dey smooth as soon as dem start.
"Wetin we do na to speculate say we go start di registration on di 8 of April, dat no be di advert roll-out.
Na only di advert fit tok di process and how you go go about dis year registration.
E get process wey we dey do and We still dey test run di system."
Oga Fabian add say one of di important process for dis year JAMB registration na di introduction of di use of NIN for all candidates.
"We no go only use NIN for di sake of NIN but we go pull student data from di central federal government database.
Dis na part of di reason why we never rollout so candidates no go dey stranded running here and there.
We dey cross di Ts and dot di Is". He tok.
Responding to wen di registration go start, Oga Fabian say: "Next week dey sacrosanct, nothing wey no go let us start next week."
Wetin you suppose know about 2021 UTME JAMB registration
For dis year registration, di National Identity Card registration na mandatory requirement for pipo wey wan register.
Earlier in di year, Nigeria government bin make am compulsory for all Nigerians wey be mobile phone user to register and get dia NIN and update dia SIM or dem go block dia line.
Di University Matriculation Exam join-body say before any student start di registration exercise, dem must get dia NIN.
Di Registrar of JAMB, Ishaq Oloyede tok dis one for virtual meeting wit owners of Computer Based Test centres say di use of NIN for registration come from Nigeria Minister of Education, Adamu Adamu and di reason na to also checkmate security issues for Nigeria.
"Na for security reasons; for our small level e go h