11/09/2026
ABEG, WE JUST DEY REMIND UNA O, BUT NO BE SAY WE MEAN'AM SHA 😂.
Sokoto DOS, make una no vex. We just wan remind una say today na 11, and September 14 dey near.
Una ultimatum to Nigerian Government still dey count down, but Abuja never reply.
So we dey reason am ahead of time:
If September 14 reach and Nigeria Government still no talk, wetin we go do?
Make we extend am? 😂
Because shame no suppose catch anybody. We fit simply add "1" in front of 4, to make'am 141 days. After all, e no reach wetin Simon Ekpa count😂 for Finland.
Shebi una know say ultimatum no be expiry date for milk, so una still fit extend'am small.
But seriously, we dey wait.
September 14 na the day.
Na action we go see, na extension we go hear, or na another announcement say “the Federal Government has been given additional time”? 🤣
Make we keep our popcorn ready because September 14 go hot.
Family Writers Press International