06/03/2026
Di Inspector-General of Police, Tunji Disu, on Wednesday tok say im go bring law and order into di Nigeria police force and e go make sure say im officers know say dem dey work for Nigerians and di citizens na dia oga.
Di IGP tok afta e inaugurate one eight-member committee for di implementation of state policing for Nigeria.
โI dey bring law and order to di table. I don make up my mind to ensure say my officers go know say we dey work for di pipo of Federal Republic of Nigeria and di citizens of di kontri na our oga,โ e tok.
Di IGP also ask officers make to treat every Nigerian wit dignity, fairness and justice, regardless of status or background.
Nigeria President Bola Tinubu bin appoint Disu to take over from Kayode Egbetokun wey recently resign from office.