
16/01/2024
This thing wey people dey talk say "back to sender" no be lie o, e dey happen true true. I go jist you wetin do me when I been dey primary 6.
So, one Friday morning, my father motor spoil, so I come dey treck go school as the school no too far from our house.
I come pass one bushy short cut like that, na e I see "devil beans", for idoma, we dey call am "enuma'jaja" for bush close to road, me I know wetin e be, so I look for pure water nylon cover hand take cut the thing, I use the nylon wrap am put am inside my school bag.
I talk for my mind say, any body wey look for my trouble, I go rub am for e body.
Fast forward to break period for school. My break money come mysteriously loss for class, I dey ask, nobody the answer me. I don vex sotey, I no even go outside go play.
Na so I tell myself say, if this people come back all of them go see pepper today, I mean wetin pass Yoruba pepper na e them go see.
I come carry my devil beans wey I hide inside my bag go round the whole locker, I rub am for the top of everybody sit.
As I finish, I trowey the thing. Break finish, everybody come back class. As them sidan for their locker, them begin scratch body.
Mumu me no know say the nylon hook for window bar near my locker. Na so breeze blow the nylon come land for my neck, plenty devil beans stings pour for my body.
Chineke!!!! I come follow the scratchers association, my own even come worse, chai!!!
The thing wey come make am worse be say, na middle of harmattan we been dey, as I dey scratch, the thing dey spread, my body dey red.
I come run from school go house without permission, as I reach house, pour water for body, Chineke!!!! Come see ajasko, the itching increase like times 100.
Only me dey inside bathroom dey cry, e be like say na co***ne addict I be.
My mother come enter bathroom dey ask me, wetin dey do you?
By this time, my body don pink like oyinbo wey dey vex.
The next thing wey I know, I dey for ground dey shout "devil beans o! Devil beans o!!!"
Na so my mother carry red oil rub all my body, put mat for me for outside, I lie down there like one out cast the scratch my body till sleep carry me.
The next morning, I remove all my books from that bag, na nylon I take my book go school that day.
As I reach school, na me first everybody come school, I make sure say I clean a the locker for class that day.
Kai!! But wickedness no dey pay fa. Back to sender dey work like magic. Biko no do person bad thing o
Β©Oyi Idoma Blessing