CNN News Pidgin

CNN News Pidgin CNN International - Pidgin Official page
We de torch � light every tori wen dey happen fo

Former Russian Prisoner Trevor Reed Details What Brittney Griner Could FaceFormer Russian Prisoner and American citizen ...
17/09/2022

Former Russian Prisoner Trevor Reed Details What Brittney Griner Could Face

Former Russian Prisoner and American citizen Trevor Reed has detailed what he believes life is going to be like for WNBA star Brittney Griner in a Russian prison.

“Regardless of how you feel about Brittney Griner’s case, that sentence is clearly political. There’s no denying that,” he said to CNN.

Griner is still behind bars in Russia after being sentenced to 9 years is in for a tough time, he said.

17/09/2022
NOW-NOW: DSS don release IPOB supota, Mama Biafra Afta she don dey for DSS net for weeks, Ukamaka Ejezie wey pipo sabi a...
28/08/2022

NOW-NOW: DSS don release IPOB supota, Mama Biafra

Afta she don dey for DSS net for weeks, Ukamaka Ejezie wey pipo sabi as Mama Biafra wey dem dey tok say, na she be di be persin wey dey do like mi-le for di leader of di indigenous pipo of Biafra, Mazi Nnamdi Kanu comot DSS on sunday.

Di oga patapata for di Kanu lega team, Ifeanyi Ejiofor confam say dem release her for one short tok wey PUNCH carri comot. E tok say, " I dey happi to tell una say, Mrs Ukamaka Ejezie (Mama Biafra) don free o. She don comot DSS net. I tank you Chukwuokike Abiama for dis success. "We no dey relax, all di prisoners wey get conscience plus awa persin wey no dey tire, Onyendu Mazi Nnamdi Kanu go soon free.

"We wey dey di lega team dey do everi tin legali to make am happun, we no dey put back for chair at all. Mek una put una mind down. Na front we go dey go, we no go go back, we move".

Mama Biafra wey don dey her 70's naim dem arrest di last time wey Kanu henta court for Abj for May 18.

Di woman don dey do like hin mi-le since di time hin mi-le die for 2020. "I see am for DSS prison afta dem wash her cloth spread for wall. I tok say, mek dem release am becos she no do anytin. Na old woman and since wey my mi-le die, I don take her as my mi-le. Mek DSS release her o, na so Kanu bin don tok.

Police tok say "We still dey find di pipo wey kill Deborah"Di sokoto state police comand don tok say der men still dey f...
28/08/2022

Police tok say "We still dey find di pipo wey kill Deborah"

Di sokoto state police comand don tok say der men still dey find di pipo wey kill di student of Shehu Shagari College of Education, Deborah Samuel.

Some student stone Samuel to die for May 2022 wey dem believe say na her classmate on top werin oyibo man dey call "blasphemy"

Di persin wey dey tok for di police comand, DSP Sanusi Abubakar, wey follo Sunday PUNCH yan ontop as di mara cool. E tok say, dose pipo wey dem arrest no be di pipo wey kill Deborah o. Dem just be part of di pipo wey organize di riot. E con tok say, dose wey dem arrest still dey police net as court don giv orda say mek dem dey. Abubakar tok say, di suspect still plenti and we dey try arrest all of dem.

Di persin wey dey tok for di police tok say, " dose pipo wey dem arrest da time no be di pipo wey kill Deborah, but be di pipo wey start di riot and dem don face court wey di judge tok say mek dem still chill for court. For dose wey kill di girl, we don carri der pishure put for everi wia and for media hass dem and we don sen awa men go for everi part of di state".

"We still dey lok for dem and we get mind say we go see dem arrest wia dem dey hide. We go flush dem com outside, arrange dem before di court of law".

E promise say di police no go do partial on top di mara and say di state comishunal of police, Muhammed Gumel go see say dem serve justice put for di mara.

$44bn Lega Batu: Judge don orda Twitter to hand ova Bot data to MuskTwitter must turn ova data from 9k akant wey dem don...
27/08/2022

$44bn Lega Batu: Judge don orda Twitter to hand ova Bot data to Musk

Twitter must turn ova data from 9k akant wey dem don use for 4th quata, 2021 audit of potential spam or fake akant for di platform- afta wetin di judge don tok on Thursday say, wetin Musk want just plenty anyhow.

Twitter dey yan say, di data no dey and e go be wahala to collect but di judge don giv di platform say mek e produce am wi din two weeks

Truss scata macron fedas wit "shey you be my padi or my enemy" Di judgment don comot o weda dem fi trust di presido of F...
27/08/2022

Truss scata macron fedas wit "shey you be my padi or my enemy"

Di judgment don comot o weda dem fi trust di presido of France, Emmanuel Macron. Acordin to UK PM Liz truss wey swear say “she go judge am wit di tins wey e don do, no be wetin hin tok”- only for Macron to lash am back for di “yeye judgement” con curse one of di British pipo wey dey to hep”

Dis coment com for di quick fire queshun and ansa event, con draw ire from her own supotas. “You for tink say di foreign secretary sabi say we dey military parole wit France,” as di foma conservative minister Gavin Barwell yan and Tory Minista David Gauke add for di mara: “Now, na one of di times wey no good to break di west”.

Presido Macron con tok to politico, “if we no fi tok weda we be enemy or padi …we dey henta serious problems” con add say hin consida di UK as pipo wey dey hep for army mara “ wit wetin dey hapun, as di mara pass di leaders own.

Dem don see di 17 years old girl wey dey loss for lagos for Bauchi Police for bauchi don see one 17 years old girl, Mild...
27/08/2022

Dem don see di 17 years old girl wey dey loss for lagos for Bauchi

Police for bauchi don see one 17 years old girl, Mildred Ebuka wey loss for Thursday di time dem sen am message.
Ebuka comot for hass for victoria island on Thursday to go drop one wig cap for her aunty friend place for Ikorodu area for Lag.
Di bauchi state police command for Friday tell pipo say, Mek dem locate di girl wey dey der side.
For di tok wey comot for twitter, di police tok say, “di persin Mildred Joshua Ebuka, woman, wey be 17 years wey dey stay for Block 19 Ubandale street, Victoria Island Lagos, wey di foto dey show for down comot hass for Thursday 25/08/2022 to go drop message of wig cap for her anuty friend for Ikorodu, as she dey go for road she stop taxi wey be bus, wey no too far from her hass, na from she see her sef for Bauchi.

“She com from lag and she dey tok oyibo well-well. She wear light blue blouse shirt and sokoto, she light and no get tribal mark”. Di state police public releshun ofisa, SP Ahmed Wakil , yan di PUNCH for Friday say dem see Mildred for park on Friday for Bauchi. Wakil yan, “di rezin why we share dis info na to find her parent. She no fi rememba anytin wen she reach Bauchi. One woman wake am up for park and she no sabi wia she dey. “so dem call police and awa public releshun office call me for di mara. Na why I mek am public”.
One of awa pipo wey run check for address of di hass tok say di street no dey.wen dem con call di Lagos State Police Public Releshun Ofisa, SP Benjamin Hundeyin, hin sef tok say true-true di street no dey. E con tok say, “Dem dey hope say her pipo go call dem wen dem see her pishure.

Breaking News: See Di way wen dem recover part of Di moni wen Abacha move comot for Naija Goment since 1998 con reach no...
27/08/2022

Breaking News:

See Di way wen dem recover part of Di moni wen Abacha move comot for Naija Goment since 1998 con reach now 2022.

Why I meet wit Atiku, Obasanjo, Tinubu – WIke Rivers state Govnor, Nyesom Wike on Friday tok say hin team get interest f...
27/08/2022

Why I meet wit Atiku, Obasanjo, Tinubu – WIke

Rivers state Govnor, Nyesom Wike on Friday tok say hin team get interest for Naijaria wey beta and dem dey tok to pipo wey get maout for di contri.

Wike tok wen e follo di pipo wey dey do news yan for pitakwa internashunal airport for Omagwa for Ikwerre local govament area, as e land Naija from Obodo on Friday. Wit am, Benue state govnor Samuel Ortom and Abia State govnor, Dr. Okezie Ikpeazu naim dem gada dey.

Wike wey confam der meeting wit PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, APC presidential candidate, Bola Tinubu; Labour Parti presidential candidate, Peter Obi and foma presido of Naija, Olusegun Obasanjo for obodoyibo tok say wetin dey top list na how to mek Naija beta pass how e dey befor.

Di Rivers state govnor tok say Naijaria neva still dey ok at all and dem dey find way to see say hope dey for Naijaria. E tok ‘I fi confam say dis na di fess time as team wey we dey meet wit di presidential candidates dem. We meet di presidential candidate of APC and we meet wit awa leader, foma presido of Naijaria, Olusegun Obasanjo.

We meet di presidential candidate of labour parti. We con still meet wit awa Presidential candidate, Atiku Abubakar. Anyhow wey e wot, we still dey follo pipo tok.
“And wetin we dey tok abat, na mek Naija beta and na for di interest of di pipo. No be say na one-way traffic or say e dey some pipo hand.
“We belive say wetin dey go on, na for di interest of Naijarians las las”. Wike condem di situashun wia dem don sell standard, training, and competence for low quality. E say leadership no suppose be one one man show and famili business but mek e for everi bodi interest.

“We still dey tok to pipo, no mind di pipo wey no belive say dis contri fi dey. “Leadership no be abat you and your famili. Na abat everi bodi. We don dey one chance for dis contri wia one man go finish eight years as govnor con bring hin pikin as govnor too and as memba of di nashunal assembli. Na for dis part of di world you go see dis kain tin wen we dey tok abat povati everi wia. Dis na pipo wey no wan mek Naija go front”. He yan.

Wike con rezin why religion and tribe be di tin to use describe Naijarians wen we nid who go fi do di job. E continue say, di only identity we get for dis contri na religion and tribe nutin else. Na say, I be Christian or Muslim or I be Fulani or I be Igbo. Naija no fi move forward except dem tink say e go be dem. Na wia we dey be da. We dey contri wey persin wey get primary skul cerfiticate fi collect Minista of foreign Affairs. Da na to tell you how bad di contri don dey”. But wit di pipo wey we dey meet dey tok to, dis mata go be yesterday. No amount of fear or say dem wan use us go scata us. We dey detamine to right all di wrong’.
Di leader of di team and Benue state govnor, Samuel Ortom, tok say dem don met wit strong pipo dem for som time now becos of der belive say Naijaria dey serious wahala and dem nid pipo to save di mara.
E say dem don get beta tok wit dose pipo wey dem don meet and di tok pass do or die politics, becos dose wey get good mind nid work togeda to se say Naijaria survive.

“For us, we dey lok di big pishure. Naija todai dey wahala, na abat wetin we fi do. No man or woman alone fi get am right for awa contri.
We dey lok how we fi take bring ideas togeda to see say we get out of di wahala wey we dey face for Naija todai.

“From top to bottom see wetin don happen from 2015 and wia we dey todai.
So wetin we dey do na di consan wey we get for awa contri Naija. Dis one pass do or die politics. We dey lok how we fi take com togeda find way to see say Naija survive. Naija dey on drip, Naija dey on oxygen and na how we fi take comot from dis wahala”, Ortom yan. E tok say di tiri separate meetin wey dem get durin di week mek sense for dem.
‘Di pipo wey we dey meet still dey go on and go continue to dey go on. We go still meet for hia. We go still meet som persin later and see how we go fit work to see say di project Naijaria work.”
For hin side, di Abia state govnor Dr. Okezie Ikpeazu press maout say, dem dey on mishun and dem dey detamine to find way save Naijaria. E say dem dey shadow di societi wey dem go giv dis genereshun, der shidren and grand shidren. E say, ‘And dis na contri wey get beta head and we nid protect am well. We tink say we nid to carri everi bodi . “We dey lok say we fi follo di civil societi organizeshun and dose wey get idea, wit Naijarians wey dey obodo. “All di resources wey dey for dis contri gas com togeda for dis time to see how good we fi take move Naija go front.”

Atiku Abubakar shock no be small for di NBA conference. Di shout-clap hand wey dem giv hin "boy" Obi loud gan wey man pi...
27/08/2022

Atiku Abubakar shock no be small for di NBA conference. Di shout-clap hand wey dem giv hin "boy" Obi loud gan wey man pikin no fi take. Obi no be "boy" again na Great man and true-true na statue of hope.

For UK yesterday, meeting wit Wike no go well wit Atiku.

KNOW SAY: DIS PAGE NO DEY SUPPORT VAWULENCE

Di Ekelebe Oga wen dem Dey comot cap give don say im nor Dey work again for di konri Japan. Di ekelebe Oga wen dey Di ko...
25/08/2022

Di Ekelebe Oga wen dem Dey comot cap give don say im nor Dey work again for di konri Japan.

Di ekelebe Oga wen dey Di kontri wen dem Dey kall Japan Itaru Nakamura don come outside talk say in don comot in hand for work say, d kind way wen dem pai di before before Prime Minister Shinzo Abe, say in fail for I’m duties, im talk dis one on Thursday,

Di pipo wen dey torchlight di way wen dem sopos Kip Di before before Prime Minister Shinzo Abe, nor tight nai make dem fit puf the man from im back with dat small puke gun wen oyibo Dey kall pistol.

Di pesin wen dem Dey shine eye giv say nai puf di man nai dem Dey kall Tetsuya Yamagami wen dey for investigation weda im get madness for head.

Follow us for back make u fit Dey see awa tori as dem dey com

Address

Aja

Telephone

+2348062488748

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when CNN News Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share