Insta Bullets

Insta Bullets Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from Insta Bullets, Media/News Company, Asaba.

News | Entertainment | Lifestyle | Hot Gist | On Air 24/7 | All For Pidgin English

If You See Something, Or You Need Advert Wire Us For DM ASAP...

TRUTH NO FIT KILL US

Obi to FG: Spending N142bn on bus terminals while health sector dey get less money na tragic irony
23/08/2025

Obi to FG: Spending N142bn on bus terminals while health sector dey get less money na tragic irony

BREAKING: BELLO MAKE KOGI LAWMAKER SIT FOR FLOOR, TELL AM TO OBEY GOV ODODO WITHOUT QUESTIONViral video don show ex-Kogi...
22/08/2025

BREAKING: BELLO MAKE KOGI LAWMAKER SIT FOR FLOOR, TELL AM TO OBEY GOV ODODO WITHOUT QUESTION

Viral video don show ex-Kogi Governor, Yahaya Bello, tell new lawmaker-elect, Hassan Shado, and him people make dem sit on the floor during meeting for Abuja. Bello warn say dem gots follow every dictate of Governor Ahmed Usman Ododo even if dem no understand am .

The lawmaker wey win Dekina-Okura II seat after INEC announce im as winner, got 55,073 votes while the PDP candidate get only 1,038. Bello use the chance tell am say political victory na team effort, and make him work with the Speaker and Assembly members to support Ododo’s agenda.

No be only that Bello talk sure say APC go continue set, with Tinubu and Governor Ododo to be re-elected, while party go secure more wins in next elections.

Tears Flow as Nigeria Legendary Goalkeeper Peter Rufai Laid to RestFriends and family no fit hide dia tears as dem bury ...
22/08/2025

Tears Flow as Nigeria Legendary Goalkeeper Peter Rufai Laid to Rest

Friends and family no fit hide dia tears as dem bury ex-Super Eagles goalkeeper, Peter Rufai, wey fans sabi as Dodo Mayana, on Friday, 22 August, for Ikoyi Cemetery, Lagos.

Rufai, wey be one of Nigeria greatest goalkeepers, die on Thursday, 3 July, at age 61, after he battle sickness for some weeks before him pass away for one hospital inside Lagos.

Plenty former teammates, football officials and supporters gather for di burial to pay last respect to di legend wey protect Nigeria goalpost for many years, including World Cup and Nations Cup tournaments.

JUST IN: Apostle Johnson Suleman Repair Major Roads for Auchi, Edo StateThe General Overseer of Omega Fire Ministry, Apo...
22/08/2025

JUST IN: Apostle Johnson Suleman Repair Major Roads for Auchi, Edo State

The General Overseer of Omega Fire Ministry, Apostle Prof. Johnson Suleman, don start serious road repair work for Auchi–Okene/Abuja Expressway and Otaru Road, Auchi, Edo State.

Locals wey dey pass the road say the work don reduce traffic wahala and improve movement for the area. Apostle Suleman say the project na part of him way to give back to society and support government efforts for better infrastructure.

JUST IN: Dem Allegedly Beat Young Man To Death For Delta Over Fake AllegationWahala burst for Oromuru, Orogun, Ughelli N...
22/08/2025

JUST IN: Dem Allegedly Beat Young Man To Death For Delta Over Fake Allegation

Wahala burst for Oromuru, Orogun, Ughelli North LGA, Delta State, as 27-year-old Mr. Anighoro Joseph allegedly die after serious beating wey some men give am.

Report talk say na Mr. Osholosholo and Mr. Julius Oderhohuo a.k.a Ayiri lead di group wey accuse di young man of selling electric socket wey dem say dem see for Federal Polytechnic Orogun. But di so-called stolen items no ever dey him hand.

Eye witness yarn say di boy na just labourer, dem torture am from night reach late yesterday wey him finally kpeme.

Human Rights Activist, Kelvin Ejumudo (SSA Human Rights, Delta State Command), don condemn di matter, call am pure jungle justice and wickedness. E vow say everybody wey dey involved go face di full weight of law.

We Say NO To Jungle Justice, Brutality Must Stop For Delta.

22/08/2025

WATCH: HADIZA MUSA BAFFA ACCUSE EX-MINISTER KABIRU TURAKI OF R**E, THREAT & DEMAND JUSTICE

Hadiza Musa Baffa don cry out say former Minister of Special Duties, Kabiru Tanimu Turaki, r**e am and still threaten her life.

She talk say the assault no be once and e don affect her wellbeing seriously. According to her, Turaki use him position of power to intimidate am and warn am make she no talk.

Baffa don carry the matter out publicly now, demand justice and call on authorities make dem hold the ex-minister accountable.

The case don dey spark plenty reactions online as Nigerians dey ask say “justice go truly reach ordinary woman hand for this country?”

Justice For NYSC Corper: Activist Kelvin Ejumudo Storms Anambra State Police Command Over Brutalization Of Miss Jennifer...
22/08/2025

Justice For NYSC Corper: Activist Kelvin Ejumudo Storms Anambra State Police Command Over Brutalization Of Miss Jennifer Elohor Edema By Anambra Vigilante

EVERY NIGERIAN MUST SABI SELF-DEFENCE —CHIEF OF DEFENCE STAFF CHRISTOPHER MUSAChief of Defence Staff, General Christophe...
22/08/2025

EVERY NIGERIAN MUST SABI SELF-DEFENCE —CHIEF OF DEFENCE STAFF CHRISTOPHER MUSA

Chief of Defence Staff, General Christopher Musa don yan say e dey very important make every Nigerian sabi basic combat skills for self-defence.

According to am, self-defence, unarmed combat, swimming and driving no be only luxury again, na survival skills wey everybody gats get.

E talk say: “The world wey we dey now no dey safe, danger fit show anytime, so make everybody prepare.”

Musa add say government suppose put more effort for security awareness training make Nigerians dey ready face any kind challenge.

Moral Lesson: No dey wait soldier – everybody gats sabi defend himself when gbege show.

See Wetin Local Government Chairman Do For Delta State Omo. All Dis Na Projects of D Chairman of Aniocha South LGA. Hon....
22/08/2025

See Wetin Local Government Chairman Do For Delta State Omo.

All Dis Na Projects of D Chairman of Aniocha South LGA.

Hon. Pastor Jude Chukwunwike

Better Person With Better Sense

Some taílors No Suppose Ever Make HeąvenTheir Heaven Na Once View. 😂😂😂😂😂😂😂😂😂💔😂
21/08/2025

Some taílors No Suppose Ever Make Heąven

Their Heaven Na Once View.
😂😂😂😂😂😂😂😂😂💔😂

Rivers State Governor, Sim Fubara Way Tinubu Suspend Don Come Abuja Come Join The Owner of Rivers State, FCT Minister Ny...
21/08/2025

Rivers State Governor, Sim Fubara Way Tinubu Suspend Don Come Abuja Come Join The Owner of Rivers State, FCT Minister Nyesom Wike To Commission Project For Abuja.

21/08/2025

The Major Reason Some Teachers No Dey Bother To Demand For Salary Increament

🤣🤣🤣🤣

NOTE: For Comedy Purpose Only..

Address

Asaba

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Insta Bullets posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Insta Bullets:

Share