26/02/2025
Following news of Kelvin Izekor wey kpuff his newly wedded wife wey her name na Success for Upper mission road for Benin city, our undercover reporter swing into action to get more details about the incident.
Neighbors of Mr & Mrs Kelvin Izekor wey speak to our reporter on condition of anonymity say na seven months ago naim Kelvin and success celebrate their wedding ceremony and no be today Kelvin don dey kponse Success even before their marriage, just that the kponsing con increase after their wedding because he get serious anger issues and he dey very hot tempered.
According to their neighbors, Kelvin don even use cvtlazz wunjor the wife for hand before.
Na in the evening of Saturday 22nd of February naim Kelvin kpuff him wife for inside house con lock door comot from house like say everything dey normal, con go bring bus to her body carry go dump for night naim one of their neighbors see am as he dey carry her body wey him don already wrap, naim the neighbour raise alarm and call police wey come gbab Kelvin.
Success friend wey also talk to our reporter say most of their friends including herself warn success not to marry Kelvin because of his vàvvulént character and them also don dey advice her to quit the marriage after them notice say the domestic vàvvuléncé con increase after their marriage but success refuse to listen to their advise.
Copied:Warri Aproko II