14/07/2025
PIDGIN TORI REPORT
YAN9JA : "VP Shettima Don Carry Buhari Dead Body Come Back Naija"
WAKA24 PIDGIN NEWS – July 14, 2025
Wetin we dey hear now na say Vice President Kashim Shettima don land for Nigeria with di dead body of former President Muhammadu Buhari, wey bin kpai for London after short illness wey dem no too talk plenty about.
Di plane wey carry Buhari co**se touch down for Abuja International Airport around 2:45pm dis afternoon. VP Shettima, some government dignitaries, Buhari family members and military officers bin follow di body waka back from UK.
Security tight well well as dem land, and national flag don already begin fly half-mast for respect of di former oga of Nigeria.
For short statement wey Shettima yarn for airport, he talk say:
> “Na with heavy heart I return with di remains of our elder statesman, a patriot, and a leader wey serve Nigeria with him full chest. We go continue to honour him legacy.”
Dem say arrangement dey ground for state burial wey go happen for Daura, Katsina State, by weekend. National day of mourning go soon dey declare, and dem don plan to open condolence register for State House and all 36 state government houses.
Many Nigerians don already begin drop tributes online, as dem remember wetin Buhari do during him time for power from 2015 reach 2023.
As more update dey come, WAKA24 go still dey give una tori as e dey hot.
– Tori by Dustin Ukuse Aisomwan WAKA24 PIDGIN REPORTER
Follow us for more updates as we dey bring una full ground gist from Abuja to Daura.