
22/09/2025
Okay story of my life... Before I marry..
Na so I waka go my in-law house for the first time. As fresh guy wey wan impress, I wear my fine shirt, iron trouser, spray perfume wey dey scatter everywhere. But wahala don start since last night because of the akpu and egusi wey I chop for junction. My belle don dey do “kung-fu” since morning.
As I siddon for their sitting room, I dey form responsible. My mother-in-law-to-be come waka commot, enter kitchen. Next thing, na correct aroma of jollof rice with fried chicken just burst enter the parlour. Omo, the smell nearly make me forget my condition. But as I smile dey look the food, my belle give me one loud warning “GRRRRRUUUUUUUUMMMMBBLLLLEEEEE”.
I hold my stomach, smile like nothing dey happen. Sweat begin roll for my forehead like person wey dey carry cement. My mother-in-law-to-be come drop the food for front of me say:
> “My son, abeg chop make you no shame.”
Inside my mind I dey beg God say: “Father Lord, if na test, abeg cancel am!”
I carry spoon, but as I wan put rice for mouth, my belle twist me again. I nearly shout “Jesus wept!” but I hold am. Na there the real problem start I no sabi how to tell dem say I wan use toilet. How I go stand up from food wey dem just serve, run enter latrine? Dem go just imagine say na the food dey purge me!
As I dey battle this thing, sweat full my body sotey my shirt don change color. My babe come whisper:
“Baby wetin happen, you no dey eat?”
I just look her, smile like mannequin, say:
“No worry, na strategy I dey use… I dey wait make rice cool small.”
But truth be say, na my stomach dey boil like generator tank. Before I know, small escape sound commot “Prrrfffff” 🤦🏽♂️. Na God cover am with cough wey I package sharp-sharp.
The moment wey I finally gather liver to stand, na so my belle squeeze me like devil hold am. I just shout:
“Excuse me ma, abeg where una bathroom dey?”
The woman point direction, and na so I fly like Usain Bolt. Bros, if you see the relief wey catch me that day ehn, you go know say sometimes love no dey sweet pass when you see toilet for where you need am! 🤣🤣🤣
IF YOU WAN KNOW HOW MY MOTHER-IN-LAW TO BE REACT WAIT FOR PART 2 IF I WAN MARRY SECOND WIFE 😂😂😂😂😂😂😂😂😂
Jessica Iziengbuwa Eyagbon Emma Osawe Kester Ehikhor Jaynyz Following MC Rocket Z咖小模-貴貴 Sammy Elam Jotham Chantal Johnbest comedian Kemzy Adeola Lion Jadox Louie Caballero Purgosa