04/04/2025
Ayy 'yan uwa, make I yarn una about Maidawa, the Bauchi-born Hausa hip-hop sensation wey dey burst speakers with mad vibes! If you never hear hin name, omo, you dey miss big time.
This guy no dey slack at all—back-to-back hits dey flow like ruwan sanyi! Check out hin latest jams:
"Hajiya" (Dec 2024) – Omo, this one na sweet jam wey go make your head dey nod. Maidawa sabi how to blend smooth beats with deep Hausa lyrics.
"Daga Ina" (Feb 2024) – Na proper gyara jam wey go make you feel the North wella. He dey ask "Daga ina kake?" and no lie, na Bauchi he dey rep!
"Wiwi Na" ft. Larabeey (2024) – Feature wey hot pass wuta mai ƙuna. The collab dey give strong Hausa vibes plus mad flow.
"Watarana" (2023) – If you dey find motivational jam wey fit ta da hankalinka, this one na sure banger.
"Gonan G***a" (2023) – This na street anthem wey don dey make waves. If you sabi, you sabi!
Maidawa no be small artist, hin fanbase dey girma kamar hadari. With over 145K soldiers backing am for Facebook and hin songs dey everywhere—Apple Music, YouTube, Shazam—this guy no dey joke at all!
Make I no talk too much—go stream hin songs kai tsaye, feel the fire, and thank me later!
***a