23/07/2026
Nigeria Senate don cut warning for Oyo State Govnor Seyi Makinde, make e stop to dey call on di United Nations to investigate di kidnapping of schoolchildren and teachers for Orire Local Govment Area, Oyo State.
Dem say if e kontinu, e fit affect di ongoing efforts wey Nigeria govment and security agencies dey do to tackle terrorism and kidnapping.
Dis warning na part of di resolutions wey di lawmakers adopt today afta dem consider one motion wey Senate Leader Opeyemi Bamidele sponsor on di successful rescue of di 39 schoolchildren and seven teachers.
Na Senator Adams Oshiomole introduce di warning and Senator Aniekan Bassey support am.