14/08/2025
Ikeja Magistrate Court for Ogba, Lagos State don discharge Comfort Emmanson Bob di Ibom Air passenger wey di airline accuse of unruly behavior including assault and breaking of parts of dia aircraft.
Ms Bob leave di court room at about 2:00pm on Wednesday afternoon after spending two days for Kirikiri prison.
Magistrate Olanrewaju Salami strike out di case based on say di prosecution team send letter to di court say dem dey withdraw all di five charges against Ms Bob.
Her lawyer Adams Atakpa tell court say dem no get objection to di new development.
Police bin arraign Bob on Monday for court on top five count charges wey include assault and other offences.
Court grant am bail dat day to di sum of N500,000, with two sureties in like sum, dem remand am for Kirikiri Correctional Centre as she no fit meet her bail conditions dat day.
Wen di case resume on Wednesday, di prosecution lead Oluwabunmi Adeitan tell court say new development dey di mata wey make dem withdraw di case.
E say di police don get new facts about di case afta di Monday sitting, say na dis make di commissioner of police decide to withdraw di case unconditionally.
For her ruling, di Magistrate say she dey satisfied wit wetin di two counsel agree, and strike out di case.
She advise Ms Bob to always display wisdom for future no matter di way dem take annoy am.
More on di tori dey here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cy4dj2vx5wlo
゚viralシ