17/11/2022
We don dey hear now say BMW don share the latest model of dem new electric cars give ALL Real Madrid players, including Benzema, Modric, Rudiger and even dem coachie oga Carlo Ancelotti make dem take dey flex. The new cars wey dem dash the players na part of the new sponsorship deal wey Real Madrid get with BMW. Each of those cars cost about 109,000 pounds and when we give Aboki FX to convert am, we see am say na about 76 million naira each naim we dey talk about so. According to the agreement, apart from the car, BMW go dey pay Real Madrid 6.5 million pounds every year and dem players and officials go dey drive only the BMW cars come training or to go play home matches or any other movement wey involve Real Madrid. But when dem reach house, dem fit drive any other car wey dem like. Before today na Audi cars naim Real Madrid players dey drive come training but now BMW don tell dem to either park dem Audi cars for house or make dem go sell am as tokunbo for Ladipo market.
My people as sponsorers don locate Real Madrid so, na so una own sponsorers go dey locate una one by one.