03/10/2021
Sapa Na Bastarhd!!!!
Yes I can Clearly Remember!
Back in Boarding school!
That was when I entered JSS1 newly
Provisions just Yakpa!!!!
Golden morn, Cornflakes, Sugar, Milk,Milo, Cabin and Even the Almighty Garri😫
Omo
Immediately school started....Omo my guys back then no gree make the Provision rest small Even our seniors dey come beg collect!
Every morning Wey Dem go serve us Tea and bread na Soo we dey put milo and milk for inside our pocket for Proper Seasoning!!..... Because there tea be like ordinary Water no taste🤕💔
Omo five days way school start I come dey look as my Dudes dey devour there provisions.....I had no option than to join them!!!
Omo I Chop everything finish before two weeks to Exam🥺💔
E come Remain only Garri and Sugar😔💔
Hunger flog me Wire that Exam week....me and Okoro go pour small sugar for mouth come also pour Garri inside 😔💔
Na that same week those Seniors Wey dey follow us Squander our provisions come tell us say Make we remain small provision because of the Exam period....or else hunger go finish us😔💔
When Níggers don already squander our Provisions with us!
We were not informed on Time
That same week, Okoro fainted inside Exam Hall......the proprietor talk say na Malaria
Na hunger hold my guy😔💔
–Ennytv 📺©