Christianity Unveiled Pidgin

Christianity Unveiled Pidgin The Ministry teaches foundational and fundamental biblical principles and topics in Pidgin English

My pipú. Na korrect knowledge naim dey save pesiñ. If u want make your faith stand ogidigba, wey go dey make satan dey r...
26/03/2024

My pipú. Na korrect knowledge naim dey save pesiñ.

If u want make your faith stand ogidigba, wey go dey make satan dey run like squirrel , den you go first allow di Holy Spirit make him open ur mind to di korrect knowledge wey u need about God.

No bí dí ordinari one wey everí bodí dey talk ó. Becus even devil know dat one too. Dis one na wisdom wey be ogbongé pass all others.

Na only Holy Spirit fit give u dat one. Bukurú no get am ó. Sense no dey dià ó and brain sef no fit work am.

Abég no dey waste time dey cry, fear or waka waka for any matá. Na dis knowledge of God u need to settle anytin with faith even to understand di kain faith sef wey u need.

I don talk am ó. Make u sef hear word well well. No tandá for strong head

Dey follow us on ejministry.mixlr.com everi Tuesday and Friday for 8.30pm WAT to understand beta di Kingdom Matta wey go help u dey waka korrect for faith and Christian life.

Christianity no hard ó. E dey sweet pass honey if u fit get am well.

Na mí rosemary ODIATU
Lead Minister
Experience Jesus Ministry


Na dis ministry dey run tins of God for this page to help una dey kampé for Christ

This channel is focused on teaching Saints in Christ how to live an eternal life experience and fulfil their divine mandate of establishing the Kingdom of Heaven, their Spiritual Leadership on Earth; having a global impact on lives, systems, structures and nations

15/02/2024

Hmmm 🤔 my pipu, no dey waka anyhow ó for dis world wey we dey. Na plentí wahala you jus dey look for ó

Baba God don prepare the road wey you suppose take. Holy Bible dey call am 'paths' of life. E tók am for Psalm 16 v 11.

Hear well as dat our yeyé enemy jus dey waka upandown dey find who é go swallow. È no go bí you in Jesú name

But you sef need to gum bodí join the Holy Spirit make e dey show you di way as you no fit see am by your sef.

No bé like pesin wey get coconut head, wey nó dey hear word ó. Abég take this tin serious as plentí tins dey happen now wey no good ó.

Na we for Experience Jesus Ministry dey bring dis spirî torí for una. Na mi Rosemary ODIATU bi di Lead small ogà for dià. God na the bigi Ogà at the top naw☝️😄

14/02/2024

Prayer dey work beta wen your mind tandà in thanksgiving than abég mind. Why? God don give u everitin finísh. Nôtin to add again

13/02/2024

My pipu, if you need anytin most, na spiritual confidence ó. Dis one pass willpower and natural kind. Na dis oné go make you strong gidigbâ inside you wey no go allow manipulation, deception or depression. U know all dí yeyé tins wey people and that werey satan dey take disturb pesin.

God don give am to you already wen you receive him salvation in Christ. Abég, use am ó. No tandà like crayfish inside basket or na you go suffer ó. I don talk my own finish.

We still dey Facebook as Experience Jesus Ministry and myself wey dey lead dis Ministry. Make you follow us for beta tins for Jesus Christ matá

Rosemary ODIATU
Lead Minister

Hello everyone. Welcome to my new page. This page is dedicated to bringing God's WORD in spoken pidgin English.....😄. Ov...
13/02/2024

Hello everyone. Welcome to my new page. This page is dedicated to bringing God's WORD in spoken pidgin English.....😄. Over the years l have realised in my times of fellowship with God that relating with Him in pidgin English is much easier in expressing my feelings. I just dey flow with ease pass dis oyibo wey we dey speak😄😄

I always say it anywhere that Pidgin English is a spiritual language 😆. So imagine my joy wen Baba God just drop am for my mind say make l kukú begin teach for pidgin English. Ah! Who l bé to refuse heavenly assignment. Ná so we see am ó.

While l also write and teach in English, this is another platform to bring the foundational and fundamental biblical principles and topics of Christianity and the Christian Life in a very simple and practical way.

So sign up and get ready to be fed the undiluted spiritual food accurately and in very basic simple steps in both text and video formats

This is a platform of the Experience Jesus Ministry of which l am the Lead Minister. I also host a bi weekly program on Tuesday and Friday at 5pm WAT on mixlr.com . It's ejministry.mixlr.com. Please tune in and hear practical insights on Christianity

Rosemary ODIATU
Lead Minister


Also you can find me on my profile and Experience Jesus Ministry page on Facebook, X, Spotify, YouTube, Instagram

Mixlr is a simple way to share live audio online. Broadcast using any source and invite others to listen and chat in real-time.

Address

Lagos

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Christianity Unveiled Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Christianity Unveiled Pidgin:

Share