12/09/2015
Mumuni like me wey no get money & wey sabi to owe people Gbese well well go dey hold the "Mama Sade Oxygen Stores" wey dey area like 86,000 naira so the madam don turn her back on me.
Now as situation come be, na me & God go come remain for Oxygen loan talks, my people na there you go hear Naija man dey give God scopes as usual
God: (Angry voice) See if you no comot from my sight na heaven thunder I go use strike you down you this chronic Oni Gbese (debtor)
Mumuni: Haba God remember say na you be the most merciful God oo, the alpha & omega, akanchawa, ka fada baba agba !!!
God: Forget !!! Common comot for here !!! You think say I still get tribal marks for face like before???
Mumuni: Oya gbafun oko faraho (Gree for am the husband of Pharaoh) Oluwa na that stupid boy dey dull me oo him never being the money since nah
God: Ogbeni park well na the same story wey you don dey give me since be that & like this I no wan hear am again
Mumuni: Ah God abeg make we no do am like that abeg, walai this time I go pay you!!! Bros J abeg help me beg am your father nah !!!
For Bookings Call: 08160335686
Follow on Twitter
BBM Pin: 566FF6E3
Another life's no rehearsals... Another brand new rib cracker from the stables of The Mumu Castle
Click this link to watch MC Mumuni's new comedy skit titled "The Drunkard's Life" https://youtu.be/AjydsCxpxOM
Shayo Na Bastard oo see person papa on a menepe mood