BBC News Pidgin

BBC News Pidgin BBC News Pidgin Official page
BBC World Service dey provide news tori and analysis from all around di world for 43 languages.

We be ogbonge international broadcaster wey dey deliver informate wey be true tok without any partia. Dis na di home page of BBC News Pidgin wey you fit see all di news tori and gist from Naija, Africa and di whole world. You fit join us every day talk wetin dey your mind, and you fit share any tori wey you wan make we cover.

30/09/2025

One assistant assistant headmaster of one popular High School for Ghana recently chop sack afta video go viral wen e allegedly dey touch di breast of e female student.

Ghanaians for dia comments since di video come out dey worry ova how many times tins like dis dey happun for schools and if students be safe for di hands of pipo wey suppose protect dem?

One of di major highlights of Independence Day celebration na di parade wey security agencies dey do wey dey end wit di ...
30/09/2025

One of di major highlights of Independence Day celebration na di parade wey security agencies dey do wey dey end wit di speech of di President.

But dis year, tins go change as Nigeria govment announce say dem no go do di usual parade.
Read: https://bbc.in/3KvIAv2

30/09/2025

One man bin japa wit im bicycle from ten Immigration and Customs Enforcement (ICE) officers for Chicago, US.

According to Christopher Sweat, wey bin film di footage, dem chase di man afta e “make verbal comments but no physical or threatening contact”.

Several pipo chop arrest for di area, as President Trump dey crack down on immigration.

Ahead 2027 presidential race, di govment of Bola Tinubu don tok say former Nigeria president Goodluck Jonathan dey welco...
30/09/2025

Ahead 2027 presidential race, di govment of Bola Tinubu don tok say former Nigeria president Goodluck Jonathan dey welcome to contest.

According to Bayo Onanuga wey be President Tinubu special adviser, e say di pipo go decide if Jonathan fit run presidency again.

"President Jonathan and odas dey welcome to di 2027 race," Onanuga tok.

Dis dey come as Onanuga reference wetin former information minister Jerry Gana bin tok say Jonathan go contest for 2027 race.

Di 54-year-old rule DR Congo for 18 years, afta e take over from im papa Laurent Kabila, wey dem shood die for 2001.Kabi...
30/09/2025

Di 54-year-old rule DR Congo for 18 years, afta e take over from im papa Laurent Kabila, wey dem shood die for 2001.

Kabila hand over power to President Tshisekedi for 2019, but dem later quarrel, wey make Kabila go into self-imposed exile in 2023.

Read: https://bbc.in/4gKWg1c

President Tinubu don join oda Nigerians to mourn di death of Somtochukwu Maduagwu wey suspected armed robbers kill for h...
30/09/2025

President Tinubu don join oda Nigerians to mourn di death of Somtochukwu Maduagwu wey suspected armed robbers kill for her house for Abuja.

Tori of di death of di 29-year-old Arise News TV presenter drop yesterday wen di media company issue statement.

Di president condemn di death of di news anchor, just as Atiku Abubakar, Peter Obi and oda Nigerians don use opportunity call for more safety for Abuja, Nigeria capital city.

Police say dem dey investigate di mata.
Read: https://bbc.in/46wU4qV

Justice Momoh Jah-Stevens na appeal court judge wey don head different cases on r**e and oda sexual vices for Sierra Leo...
30/09/2025

Justice Momoh Jah-Stevens na appeal court judge wey don head different cases on r**e and oda sexual vices for Sierra Leone.

E dey popular for Sierra Leone judiciary system, and di current allegations against am don raise serious kwesions.

Sierra Leone Judiciary say dem go transfer di appeal court judge go di 'Judicial and Legal Service Commission (JLSC) for dia consideration.'

Read: https://bbc.in/4o11sRi

Why US govment fit shut down and wen e fit happunOva di past nine months, Trump administration don cut spending and sack...
30/09/2025

Why US govment fit shut down and wen e fit happun

Ova di past nine months, Trump administration don cut spending and sack workers from dia jobs, testing di boundaries of presidential power.

A shutdown fit allow di administration to speed up dia massive reductions.
Full tori: https://bbc.in/3VLoUWu

DStv subscribers for Ghana dey react hours afta di kontri minister for Communications, Digital technology and Innovation...
30/09/2025

DStv subscribers for Ghana dey react hours afta di kontri minister for Communications, Digital technology and Innovation Samuel George announce fresh bouquet packages afta weeks of 'fight'.

For one joint press conference between management of multichoice Ghana and di communication ministry on Monday, Samuel George announce say di service provider agree to offer Ghanaians 'better value' for dia subscriptions wey go take effect from 1 October.

Di minister for early September threaten to shutdown Multichoice Ghana DStv operations if dem fail to reduce prices of dia packages by 7 August, at a time di kontri dey witness reduced inflation and stable currency wey dey gain value against di major foreign currencies especially di dollar.

More on dis tori dey here: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c059dq1jv18o

30/09/2025

Live from Accra wia coalition of newly posted teachers dey demonstrate to demand payment of dia salary arrears of 13 months

One Chinese national don chop conviction afta one international fraud investigation wey result in wetin dem believe say ...
30/09/2025

One Chinese national don chop conviction afta one international fraud investigation wey result in wetin dem believe say na di single largest cryptocurrency seizure for di world.

Di Metropolitan Police say dem recover 61,000 bitcoin wey worth more dan £5bn ($6.7bn) in current prices.
Zhimin Qian, also known as Yadi Zhang, bin plead guilty on Monday for Southwark Crown Court say she illegally acquire and possess di cryptocurrency.

Between 2014 and 2017, she bin lead large-scale scam for China wey involve cheating more dan 128,000 victims and store di stolen funds in bitcoin assets, di Met tok for statement.

Met Police say di 47-year-old guilty plea follow a seven-year probe into a global money laundering web wey begin wen dem get a tipoff about di transfer of criminal assets.

One Nigerian deportee, wey dey among di 15 pipo wey US send to Ghana, don share how Ghana transport six of dem to Togo.D...
30/09/2025

One Nigerian deportee, wey dey among di 15 pipo wey US send to Ghana, don share how Ghana transport six of dem to Togo.

Di deportee wey no want make we mention im name explain say dia lack of documentation don make am extremely difficult for family members for US to send financial support.

“None of us get family for Togo. We just dey stuck for hotel,” e tok.

“Right now, we just dey try survive until our lawyers fit help us wit dis situation.”

Di Ghana authorities neva comment on dis mata.

Address

Lagos

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when BBC News Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to BBC News Pidgin:

Share