BBC News Pidgin

BBC News Pidgin BBC News Pidgin Official page
BBC World Service dey provide news tori and analysis from all around di world for 43 languages.

We be ogbonge international broadcaster wey dey deliver informate wey be true tok without any partia. Dis na di home page of BBC News Pidgin wey you fit see all di news tori and gist from Naija, Africa and di whole world. You fit join us every day talk wetin dey your mind, and you fit share any tori wey you wan make we cover.

Nigerian Law School don confam di death of one of dia students, Faith Alayande wey die from heavy fall from di hostel ro...
11/08/2026

Nigerian Law School don confam di death of one of dia students, Faith Alayande wey die from heavy fall from di hostel rooftop for Lagos Campus, according to statement from the school.

But wetin we know? https://bbc.in/4gcEwMG

US President Donald Trump tok say e go be "terrible mistake" if dem remove Fifa president Gianni Infantino from im posit...
11/08/2026

US President Donald Trump tok say e go be "terrible mistake" if dem remove Fifa president Gianni Infantino from im position under-pressure.

Trump support dey come afta Uefa, Concacaf and di Asian Football Confederation (AFC) bin issue one open letter wey accuse Infantino say e break trust "through deception" wit im aborted Fifa Forward Enterprise (FFE) proposal.

FFE for mean say dem go create one new company wey go manage commercial and ticketing rights of all Fifa competitions, wey include World Cups, and dem go sell 21% to one private investment company.

Trump comments mark di first time e go come out to defend Infantino since di FFE plans come to light on 28 July.

"Fifa go make terrible mistake if, for any reason, dem even consider to replace Gianni Infantino," Trump write on social media.

Di South African govment don release travel warnings across di kontri dey tell pipo to dey vigilant and exercise caution...
11/08/2026

Di South African govment don release travel warnings across di kontri dey tell pipo to dey vigilant and exercise caution as heavy snowfall, freezing conditions, heavy rain and strong winds dey currently happun for many parts of di kontri.

Read: https://bbc.in/4i2mI9j

11/08/2026

Liliana Pérez Ocampo and her family members manage escape moments bifor ogbonge earthquake shake dia house for western Colombia on Monday.

“At first, we bin tink say na small tremor like di ones wey Dey usually happun for Colombia, but wen afta 30 seconds pass and evritin still dey shake well-well, we realise say na earthquake” na wetin di mama of four children tell di BBC World Service.

Her family including two young children for school, dey safe. “In di end, we go replace material tins” na wetin she tok.

“Di most important tin na life, and we get am”.

Wit at least 132 pipo wey don kpai, dis na di strongest earthquake to hit Colombia for di 21st century, according to Geological Service for di kontri.

Last month, Donald Trump secretly travel from Turkey go Britain inside one small military plane - White House neva react...
11/08/2026

Last month, Donald Trump secretly travel from Turkey go Britain inside one small military plane - White House neva react to di tori.

But how e take happun?
Full tori: https://bbc.in/3SqJz40

Europe goalscoring crown dey go back to FC Bayern – afta Harry Kane impressive seasonGolden Shoe award for di top scorer...
11/08/2026

Europe goalscoring crown dey go back to FC Bayern – afta Harry Kane impressive season

Golden Shoe award for di top scorer for di whole of Europe dey go to di striker for di second time for di 2025/26 season, afta e win am for 2024.

Kane score total of 73 goals for 65 competitive appearances for club and kontri for di past season, as well as setting up eight goals.

Kane don join exclusive list of players wey don win di Golden Shoe two times – na only Lionel Messi and Cristiano Ronaldo don achieve am more times.

Dem go present di trophy for di FC Bayern Museum on 19 August.

11/08/2026

Technology don change di way plenty businesses dey operate for Nigeria.

While technology don disrupt some traditional businesses, e don also create new opportunities and open doors for new businesses to grow.

Which oda business technology don change?

Producer x Edit: Mobolaji Olatunde

Di kontri aviation authority don report damage for many regional airports, including di ones wey dey Pereira, Manizales,...
11/08/2026

Di kontri aviation authority don report damage for many regional airports, including di ones wey dey Pereira, Manizales, Quibdó, Armenia, Cartago and Buenaventura.

Di quake come less dan two months afta twin quakes finish di north of Venezuela, wey kill more dan 6,300 pipo.

Read: https://bbc.in/4wReaXk

We hail oh!How you see dis proverb Lanre Ariyo drop for we dormot?Tell us wetin e mean and no forget to share your own f...
11/08/2026

We hail oh!

How you see dis proverb Lanre Ariyo drop for we dormot?

Tell us wetin e mean and no forget to share your own for comment.

Death toll from Colombia 7.4 magnitude earthquake don rise to 111.Dis earthquake dey come less dan two months afta twin ...
10/08/2026

Death toll from Colombia 7.4 magnitude earthquake don rise to 111.

Dis earthquake dey come less dan two months afta twin quakes destroy parts of Venezuela, wey kill more dan 6,100 pipo.

Full tori: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cevmkedyx88o

Address

Lagos

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when BBC News Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to BBC News Pidgin:

Shortcuts

Share